Tori As We Dey Waka Come: Militry don waka collect presidential power for Guinea. Dis gbas gbos matter, sup today wey be, Sunday 5th of September 2021, inside this hot sun as e dey hot, Di oga wey carry dis waka na LT Colonel Mamadi Doumbouya, na him sojias dem waka go arrest di presido wey don dey for power since December 2010. Guinea pipu dey jubilate with happiness has dem don collect presidential power for President Alpha Conde hand. Di soldiers yan say dis presido power wey dem waka come collect by fire by force, na ontop say di kontri pipu, dey die ontop dis poverty and corruption. Na who be dis Guinea presido wey dem dey call Alpha Condé, dis man na 83 years old, dem born am di year 1938 4th of March, him be politician wey don dey for Presido power since December 2010 till now wey gbege don happen dis month September 2021, dem don waka comort am for power. For advert and sponsorship Call 08133385379 As We Dey Waka, No Be ...
Tori As We Dey Waka Come: School Resumption Stop, As House of Representative Dey ask for 3months before schools go fit open back again House Of Representative, don waka against federal Government wey talk say make school dem open Today wey be Monday 18th of January 2021. Di House Of Representative, Don fall federal Government hand on top Dis school opening matter, Dem say coronavirus don come up, Dem talk Dis inside book say, coronavirus Dey very dangerous and E Dey kill pipo, Dem no go fit agree make school open inside dis coronavirus. Na on Saturday 16th, 2021, Dem write on top paper give Prof. Julius Ihonvbere, wey be Di chairman of House Committee, on top Basic Education and service, inside Dis Paper dem yan say, make dem check how coronavirus dey kill pipo, dis na di second wave, e be like say dem dey play on top dis coronavirus, because school no suppose open now, we school never ready to open at all, coronavirus no sabi small pikin, E dey kill plenty pipo everyday. Di...
Tori As We Dey Waka Come: After Di announcement about Di election wey dem do for Uganda, pop star Bobi wine, waka yan press pipo about di magomago and wuruwuru wey happen on top this election. Him yan say, na lie lie result and him no go accept am, say Yoweri Museveni no be him presido. Just after him yan dis matter for him house, na him soja plenty stand in front of him house, dem no allow any body to enter again to go see Bobi Wine, and him no fit come outside to see anybody, dis one na house arrest dem give am, soja jump enter Bobi Wine house, when him wife dey try plug fruit wey dem go chop, as food don finish inside house for dem to chop, di soja no allow bobi wine wife to plug di fruit, now Bobi Wine dey cry out to pipo to helep chook mouth inside Dis matter, as food don finish inside house, and dem no allow dem to come outside. 76 years old Yoweri Tibuhaburwa Kaguta Museveni, wey don be President for Uganda since 1986, don waka put him self again as the presido of Uganda, na ...
Comments
Post a Comment