Plasings

Wys tans plasings vanaf Oktober, 2022

Lagos Bus Driver on strike - Governor beg for meeting to see them on Wednesday.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: No be small gbege as pipu bin dey stranded for bus stop inside lagos, for early mor mor of today wey bi Monday 31st of October  2022, based on say commercial bus drivers under the umbrella of the Joint body Drivers’ Welfare Association of Nigeria (JDWAN) bin start seven-days strike because of anyhow extortion wey government officials dey do them. On dis strike waka, na so di transportation money waka come up...as pipu con dey pay plenty money to fit waka go dem destinations.  From Ijaiye to Oshodi wey be N400, before don  increase to N700 While transport money From Ijaiye to Agege waka come up to N400 instead of N200 naira. As E Dey Hot On top Dis Transportation waka  The Lagos State Government don call the ogas dem for Joint Drivers Welfare Association of Nigeria, JDWAN, to do meeting on Wednesday, 2nd of November so that dem go fit find solutions to everything wey dem dey ginger for. dis na di list of pipu wey do dis. Strik

Nigeria Navy waka with NAPTIP Rescue 50 girls from Ashawo Trafficker pipu hand.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Di Nigeria Navy on top water don waka rescue 50 women from ashawo waka, on top dis matter as e dey hot, dem don arrest 3 pipu wey dem dey suspect say na ashawo International waka, dat wan wey oyinbo dey call sex traffickers inside Port Harcourt. Lt.-Cdr. Richard Iginla, Base Information Officer, Nigerian Navy Ship (NNS) Pathfinder, do did waka to rescued dis victims for PH city on Sunday. Iginla yan say did waka join body with Nigeria Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) and the Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC). According to Iginla, inside Dis 50 Ashawo teenage girls follow dey inside wey dem  rescued, early mormor on Saturday. Dem yan say na with di help of NAPTIP, wey give dem dis information, because dem self don dey do investigation on top di matter, with small pikin of  14 years of age. Na 50 young girls dis traffickers forced into ashawo work, that wan wey oyinbo

Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball for penalty shootout

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  On top we sport waka with Nigeria Under 17 women. We Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball wey make we kuntry win Germany for bronze medal  We Nigeria’s U-17 Women’s team, Flamingoes give Germany wotowoto on top penalty, we dem use collect bronze medal inside dis FIFA U-17 Women’s World Cup sport waka, dem give 3-2 dem give Germany ontop penalty we dem play. We Nigerian Flamingoes bin dey 3 goals before Germany waka draw with dem, na dis draw we dem two enter make dem play penalty. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Danfo Bus for lagos Go waka Protest on Monday, dem go Boycott work - Dis na why

Prent
Tori As We Dey WakaCome: All di commercial driver for lagos state don yan  say, dem go waka for seven days protest. According to dem, Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state. Dem waka come with di Joint Drivers' Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend. Wan person wey be JDWAN too say dem dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management. Dem National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state. WATING DEM DEY ASK FOR  Bus drivers for Lagos say dem no wa

President Buhari yan on top di Terror wahala inside Abuja

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Nigerian President Buhari don react on top di terror alart inside Abuja, BuBu yan say make una no fear say di US and UK advice to dia pipo no call for panic. Nigeria President Muhammadu Buhari say di terror alert by di foreign kontris no mean say attack go happun. Nigeria leader reaction dey come as some kontri bin first issue terror alert say threat of terror attack dey for Abuja. Bubu yan for statement wey im tok-tok pesin, Garba Shehu release on Friday say im don charge security operatives to dey alert since afta di attack on Kuje prison. “No be only Nigeria dey di list of terror threats by foreign goment travel advice to to dia citizens. UK and US travel advisories also tok of  terror attacks wey fit happun for many Western European nations. “However, e no mean say attack go happun for Abuja,” di statement tok. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com

Flood water kill pipu for Yenagoa, di Bayelsa State capital inside Nigeria

Prent
Tori As We Dey WakaCome: How di death of 16 year old Temedi  Yerimene wey drown becos of flooding for Igbogene community for Yenagoa, di Bayelsa State capital, Southern Nigeria na one of di major losses pipo dey count for di flood palava Nigeria dey suffer so. Di boy na from Amabulu in Ojobo community of Ekeremor LGA of Bayelsa but di family dey live for Igbogene. Tori be say di flood push di young boy into di deep canal for di area wen im and im friends go swim for di flood water close to di Bayelsa Ecumenical Centre. Mama of di boy, Yerimene Waka Come yan say di incident happen on Monday 10 October 2022 around 11am in di morning wen im go swimming. "I come back from market and dem tell me say im go swim. I bin think say im go swim for di water wey dey flood for our compound until one of im friends tell me say na di flood drag am into di canal." Efforts by di community search party wey go search for di boy no dey

Obi waka on top presidential matter

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Today wey bi Saturday, Naim Labour Party’s presidential candidate, Peter Obi start their own campaign sake of the February 2023 wey dey come for front.  Dem start am for inside Lafia, the Nasarawa State capital in the North-Central geopolitical zone of Nigeria. Him running mate, wey be Datti Baba-Ahmed; and National Chairman of the Labour Party, Julius Abure; and other 1,234 members of the party campaign council land gidigbam for the venue of the rally on Saturday around 11am. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Naira note matta never clear

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, don come reject the plan wey Central Central Bank of Nigeria (CBN) bring come out to redesign our naira, as she come dey cut warning dey give CBN say if e happen ehn, E go do 'ntoor' to our economy wey don already keep face like 'fowl wey rain beat' She blame CBN say dem no consult Finance Ministry first before dem take di decision.. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

CBN New Naira note waka

Prent
Tori As We Dey WakaCome: One Former Deputy Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Kingsley Moghalu don come out dey yarn, say that decision of CBN to redesign the naira note make sense die, say na good step for our economy. He still shalaye, say CBN dey try to control the supply of money inside the economy.  See as he talk... ''If 80% of bank notes inside circulation dey outside bank, na wahala be that.  Wetin CBN dey plan, na to force all those akpalakpala wey dey outside, make e enter back inside bank. Those wey hold money must surrender to get new ones or else e go become illegal tender after January 31 2023. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Lugbe Abuja Estate

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Trademoore estate Lugbe, No be news again say no be small High Powered Sting Operation naim bin shele in Phase 3 this afternoon, wey make dem shut down the estate completely. Joinbody of DSS team and other team also put body for this level. We bin no get the full details of the reason(s) why the operation bin happen, but report bin dey about allegate of terrorist activities.  From our side, wey dey inform everybody to dey vigilant, KNOW YOUR NEIGHBOURS and report any kurukere movement, person or activities wey u no understand to Police, the Exco and Street Reps. Finally, make  we dey calm and continue to dey do our everyday activities within the Law. God bless and protect us all. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv