Posts

Showing posts from January 26, 2021

MAMA's AWARD: Na Who Be Di Best African Artist?

Image
Entertainment Waka: MAMA AWARD 2021 Di name of di Nigerian artist wey go carry Join body for Dis Honour Award, na Davido, Wizkid, Burna Boy, Simi, Dj neptune and plenty others. Dem don nominate Burna Boy, 2 times for Di best collabo, for Dis song, "Monster You Made", wey him waka do with Chris Martin, and di song wey him do with South African Artist, Master KG, remix of Jerusalem jam, Na dis songs wey make dem nominate am for best collaboration artist. Dem also nominate Simi and Adekunle Gold enter nomination category for Best Alternative.  Di pipu wey follow dem enter dis waka na some Ghanaian superstars, Amaarae, alongside South Africa’s Ama Faku and Kenya’s Matata. Wizkid (Smile, ft H.E.R.), Yemi Alade (Shekere ft Angelique Kidjo) and Burna Boy (Monsters You Made ft Chris Martin), dis na all di pipu wey waka enter nomination for di Best Collaboration award. Afro-Street/Pop artiste, Naira Marley, enter waka for Best Fan ba...

Yemi Alade and Patoranking: Something Romantic Dey Go On.

Image
Entertainment Waka: Yesterday, 25th of January, our own award winning, Super talented Nigerian artists post dia pictures for dia Instagram page, of the both of dem for di same traditional cloth for one traditional wedding wey happen last weekend. Tori wey reach us be say, this two talented lovebirds don dey cook something lovecious underground since. Na dia the same the same cloths and dia hands tied together, for the event na him make the before before rumour true. Dis two superstar artists, don dey call dem selves sweet sweet names for social media page. Top celebrities sef and many people don dey use the matter congratulate dem for their social media handles. Skyrocket Patoranking and Yemi Alade, WakaComeTv dey congratulate whona two oo. We dey wait for whona to serve us di sweet love aroma wey we dey perceive. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #tor...

Militan enter Imo State, wey make Curfew start on monday January 25, 2021.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Governor Imo State on Monday, January 25, 2021, yan about waiting dey sup wey make am declare curfew. Governor Hope Odidika Uzodinma, don yan give doesesidents of him State, say, time go dey dey wey pipu no go fit waka come outside at all, him do dis waka on top wating happen inside some local government areas fo Imo State, na only 9 local government dis curfew dey waka with, di name of dis 9 local government na, Orlu, Orsu, Oru East, Oru West, Ideato North, Ideato South, Njaba, Isu, Nwangele and Nkwerre local government areas of Orlu zone. Di Governor take dis action after wetin happen for Imo state with some soldiers and militants. Some pipu talk say di matter wey happen between soldiers and militants pipu, wey dey worry ontop di State, according to di pipu wey see as di matter happen, say di militant don kill and destroy things. Governor dey beg di security pipu, make dem catch dis bad pipu wey dey do dis killing, to fit put dem for jail, dis...