Plasings

Wys tans plasings vanaf Februarie, 2023

Naira Note wahala inside Nigeria

Prent
Tori As We Dey Waka Come:  As E Dey Hot, On Sunday  Kano state goment shutdown popular supermarket, Welcare ova accusation say dem dey reject old naira notes even though Supreme Court give order say make pipo continue dey use am. After di shutdown, some Kano state goment officials also comot on social media dey ask pipo to name shops or businesses for dia area wey dey also reject old naira notes so dat dem go suffer di same fate as Welcare . Dis follow di end of di deadline wey di Central bank of Nigeria set for di old naira notes to be legal tenders for Nigeria following di naira redesign policy. Acting chairmam of Kano consumer protection council, Baffa Dan Agundi, wey carry out di shutdown order, tok say govnor Abdullahi Ganduje yarn say anybody wey no collect old naira notes dey violate wetin Supreme court tok. Dis na action wey go continue as Senior Special Assistant to di govnor on new media Abubakar Ibrahim ask pipo for social media to send addresses of businesses wey no gree co