Posts

Showing posts from March 3, 2021

Daniel Wilson Timeless Album: dis na new gbedu, wey just waka come outside, as e dey hot.

Image
Tori As We Dey Waka Come: We dey jolificate with we Nigerian Music Icon, for we industry, na Legendary Musician im be, we dey talk about our one and only Daniel Wilson, wey be king of RnB music, im don come out with dis Album wey him call am, TIMELESS. Dis na cool jam for old and young, na im oyinbo man dey call ever green music, di song dey sweet for body. Dis Album na 18 tracks wey dey totori person, as e dey hot. Track: 1. language barrier (feat. Abobi Eddiroll) Track: 2. Abortion (feat.BZB) Track: 3.  Good Old Days Track: 4.  The Virus Is Real Track: 5.  Mr Ragamuffin Track: 6.  Oyato' (feat. Gran-P & Obitunez) Track: 7. My Body Is Getting Weak Track: 8.  Heartbreaker Track: 9. 999 Track: 10. Children Of Africa Track: 11. One Naija Track: 12. The government You Deserve Track: 13. Jonathan Been Try Track: 14. Do Something Track: 15. The Youth Are Taking Over Track: 16. Personal Person (Feat. BZB) Track: 17. Foll...

Covid19: See Who Go Collect Di 3.92 Million Doses Qf Di AstraZeneca Vaccine Wey Just Enter Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Picture of di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine wey just enter Nigeria. AstraZeneca vaccines don enter we kontri Nigeria, dis go make Nigeria di next West African kontri to collect di COVAX Facility after Cote d'Ivoire and Ghana. Di arrival of di vaccine go enable dem begin vaccinate Nigerians in priority groups, starting with di frontline health workers, na so NPHCDA talk. At all levels, di cold chain facilities wey dem go store di vaccine don dey ready. Mr Osagie Ehanire wey be di Minister of Health for we kontri Nigeria, don receive di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine as e arrive di kontri capital, Abuja yesterday. Dem don dey train all di health workers wey go administer di vaccination, na so di National Primary Health Care Development Agency, yan inside statement wey di World Health Organization and UNICEF join body do. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmai...