Plasings

Wys tans plasings vanaf Februarie, 2022

Russia and Ukraine War: Black Africans left behind evacuations

Tori As We Dey Waka Come: Tori As We Dey Waka Come:  Dis na update, As E dey go, OnTop this wahala wey dey happen inside Ukraine, Russia Don scater dem with bomb and plenty Russian soja don enter inside Ukraine dey kill pipo, as dis matter dey happen, plenty pipo dey run waka comfort for di country, has dem start to dey transport people comort, dem refuse to carry black Africa student, dem forget say black live self matter ontop dis, we dey beg we Nigerian Government make dem check this video to fit arranged how dem go fit carry dis student comort for Ukraine. Dis na Tori As We Dey Waka Come, As We Dey Waka, No Be Lie. Video   Click on top this link to see this video: video Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

Ex-Boy friend scatter Traditional marriage

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Wahala be like wating again!  Dis na bad waka has e dey hot for wan hot afternoon na him, wan woman wey her name be Miss Idara Elijah Okon, she dey jolificat onTop Her Traditional marriage na him her former Ex-Boy friend waka come with plenty pipo to do scater scater for 5he venue, dem waka scater everything, everybody wey come dis wedding goes has dem see area boys wey waka enter with wahala. Dis man wey him name na Sampson Effiong Eto, yan say him no go gree at all make Dis wedding happen unless Miss Idara Elijah Okon pay him back all Di money wey him Don spend ontop am, di money wey him dey ask for na 22M naira. Dis matter happened for Chief Elijah Okon Edet Compound at Afaha Efiat Iman, Etinan LGA, Akwa Ibom State. Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.