Plasings

Wys tans plasings vanaf April, 2021

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Over 3,000 pipo don dey homeless as Boko Haram don collect dem village.  Di Niger State Governor, Abubaka Sani Bello don talk about we kontri Nigeria, on safety on top bokoharam matter, him talk inside dis video say, bokoharam don carry flag come outside for Kaure village inside Niger State. Him yan on top dis matter say na only 2hours this pipu fit take waka to Abuja from Niger State, him say make Federal Government help for security, as Niger State no far from Abuja. As di matter dey sup now, Abuja sef no dey safe again according to di tori wey him yan press pipo inside dis video. Click on dis link to fit see the video.πŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌ Bokoharam take over kaure village wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

58 Years Old Mother Raped to Death: In Calabar, Son Cries Out For Justice.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: One Nigerian man waka come on top social media for help on top him mama matter. Di man waka come outside to tell pipo make dem hellep am locate di pipo wey come kill him mama for house. According to di tori wey him talk on top twitter, him dey beg we kontri pipo, make we helep am find dis pipo wey beat him 58 years old mama to death. Madam Doris Andy Inyang, na business woman for Housing Estate inside Calabar wey dem kpai on Wednesday, April 14th 2021. Her son yan dis matter ontop dis twitter account @uti_xo, di man talk say dem rape him mama, beat him mama, strangle am, and cut her wrist. Dis pipo wey waka come attack him mama, di man talk say dem carry waka with some document and him own motto join. Ontop him twitter him talk all dis matter wey happen to him mama, him dey cry out for justice and to we pipo make dem helep am locate di motto wey di wicked pipo carry waka go. wakacometv.blogspot.com send your T

Academic Staff Union Of Polytechnics(ASUP): waka with Strike on Today.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di Academic Staff Union of Polytechnics (ASUP) don waka come with update say dem dey Declare Immediate Strike Over New Salary Scheme for we kontri Nigeria. Di National President of ASUP, Anderson Ezeibe para say union’s strike must commence till dem meet all demands by the Federal Government. According to di union, di matter on Tuesday 6th of April 2021. ASUP leaders don confirm di strike matter  after him waka do meeting with Federal Government officials for Abuja. Asides dis strike matter, dem dey yan say make dem put money ontop di new salary scheme, the union dey yan say make dem pay dem di salaries and promotion allowances wey dem never pay lecturers.  National President of ASUP, Anderson Ezeibe wey dey insist say strike go go on, him say dem don dialogue with the Federal Government to resolve the issues wey dem raise.  wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or wha

Nigeria President Waka Come UK for Medical Treatment.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian pipo wey dey obodo oyinbo land for UK, don waka protest against president Buhari medical trip. Him bin comot Nigeria on Tuesday 30th March, 2021 for two weeks medical checkup. Di protest waka come ontop di residents doctor's strike matter, wey dey sup for Nigeria. Dis waka wey start on 1 April, 2021-  days afta Buhari land London for im medical check-up. Dem dey yan ontop di protest say, government dey owe doctors dem salary and also refuse to pay oda allowances dem suppose get during di coronavirus pandemic. To express dia displeasure for di medical trip, Omokri lead a group of protesters to protest for di gate of di Nigeria Abuja House, dem parra well well, say make presido waka go back to Nigeria go do him medical checkup.  Dem dey vex say why di president go comot Nigeria wen Nigerian doctors dey on strike. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348

Gunmen Attack Prison for Owerri on Monday.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Gunmen on Monday April 5th 2021, attack di Nigerian Correctional Services (NCS) for Owerri, Imo state capital for South East Nigeria. According to di tori, E happun around midnight and e never clear well well if prisoners escape from di prison. Na About 30 vehicles na im di gunmen burn down inside di police headquarters wey dey di same area. Di police headquarters dey opposite di Imo state government house. E no dey clear who carry out di attack at di moment. Dis no be di first time hoodlums dey attack prison officials and dia facility for Imo State. IGP for di statement wey im tok tok person CP Frank Mba, release say "di attempt by di attackers to gain access to where Police dey keep dia weapons for di Headquarters fail as officers wey dey on duty no allow dem. Di place where Police dey keep dia weapons dey intact and di police no record any death apart from di Police constable wey sustain mino