Posts

Showing posts from January 9, 2021

Election Wahala for Inside Uganda.

Image
Tori As We Dey Waka Come: No be today Uganda President dey use him kontri security officers dey threaten, him rival. Him don use dem to arrest Bobi Wine, plenty times, just to tell am say, na him still be di presido and him no go allow Bobi Wine enter power as President. As the matter dey go, him security officer dey arrest any news reporter wey dey chook mouth inside di matter. Bobi wine wey be di leading opposition party don waka go report all di wahala wey di President and him security officials dey do for di kontri, give International Criminal Court.  The leading opposition presidential candidate, Bobi Wine, yan as di matter be to International Criminal Court say make dem investigate human right violations. On top this yan him talk as dem carry am inside motor, and so many things wey him eye don see since di election start. As the matter dey hot, this week on Thursday na him Uganda police carry Bobi Wine, drag am comort inside him motor with him supporters. On top say next...

CAF don hold draw.

Image
Tori As We Dey Waka Come: On top Sportwaka. CAF don hold draw for Champions League group stage, Confederation Cup qualifier  Dis match happen for inside Caf headquarter for Cairo, Egypt. Na for there dem do dis waka for dis season’s Champions League group stage, on Friday, the 8th of January. Di champions way be Al Ahly of Egypt go begin the defense of their title against Al-Merreikh of Sudan for Group A, wey be former winners AS Vita Club of DR Congo and Tanzanian giants Simba S.C. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #sportwaka

Boko Haram kill 13 pipo inside one village for Cameroon.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Boko Haram kill 13 pipo inside one village for Cameroon. Di Mayor of Mozogo, Boukar Medjewe, talk say, Pipo start to dey run enter bush to hide when dis pipo enter dem village with wahala, 8 pipo die on top dis matter. Dis na the latest tori about Dis jihadist group, way done dey happen for north since 2014. Dis week 3 vigilante die for di hand of dis group. 2 Cameroon soja get injury and 14 house burn for inside dis attack wey happen last week inside one village. The matter wey reach us be say, so far, 2,500 Cameroonians don die for the hand of dis Boko Haram pipo since 2014 to 2017. National Ministry of Defence na him yan Di matter. Di UN Refugee Agency pipo don gader up to 26 million pipo for lake chad kontri wey wahala of Boko Haram affect, since di time wey dem start this bad waka for 2009, inside northeast for we kontri, Nigeria and outside kontri wey dis matter affect. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com...

Covid-19: New Lockdown for we Kontri.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Federal Government of Nigeria on Thursday talk say, dem dey reason make Dem start new lockdown for we countri, as di matter on top this Covid-19 dey go up. According to Tori way dem talk, “On the 6th of January 2021, dem record, 1,664 infections. Dis na another all-time high rate for Nigeria. Make we pipo take full responsibility through compliance and vigilance.” Sani Aliyu way be di National Coordinator of the Presidential Task Force on Covid-19, talk for Abuja. “If dis numbers continue to go up, and pipo continue to dey die, di only option go be to lock down di kontri. Di Secretary to the Government of the Federation, Boss Mustapha, wey talk dis tori, talk say “The Presidential Task Force dey very concerned about the increasing daily numbers wey dem record. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome