Posts

Showing posts from May 17, 2023

Obodo Oyinbo Museum Wey Waka Come Carry Ghana Gold For Asante Don Yan Say Dem Go Like Borrow Am Back From Asante Palace

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Di ruler of Ghana Asante pipo don ask British Museum to return gold items wey dey dia hands to im kontri. Di Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, recently meet di museum director Dr Hartwig Fischer for discussions. Di items wey dey di museum hand include work wey di British take from Asante palace for Kumasi during war wit di British for 1874. Di British Museum tell tori pipo say im dey "explore di possibility of borrowing di items" to Ghana. Di Ghana ruler meet Dr Fischer last week, afta im di Coronation of King Charles. Ghana goment don set up Restitution Committee to torchlight di returning of items wey dem take from Asante Palace wey now dey for different pipo and institutions hand around di world. Nana Oforiatta Ayim, wey dey di committee, tell tori pipo say: "Dis objects na mainly sacred ones and dia return no be just about restitution. Na also about reparation and repair, for places wia dem from take dem, but also di pipo wey do di taking....

Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident"

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident" wey involve tori pipo, one talk talk persin to di prince confam. Di mata happun afta di Duke and Duchess of Sussex attend one award ceremony for New York on Tuesday. For inside statement, di prince talk talk persin say di "continuous pursuit" bin last ova two hours. Dem add say e remain small make dia motor jam oda drivers for road, pipo wey dey waka come and police officers. Di talk talk persin say, "even though to be public figure dey come wit some interest from di public, e no reach to cost anybody safety". Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Nigeria President Elect: Bola Ahmed Tinubu on phone call with Anthony Blinken Di US Secretary of State.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di United States Secretary of State Antony Blinken emphasis im commitment to continue strengthen di relationship between Nigeria and im kontri for di new govment wey go soon enta office. Oga Blinken give dis assurance during im first official phone call to Nigeria president-elect Bola Ahmed Tinubu on Tuesday. Di Secretary yan say US-Nigeria relationship don go way back and say dis relationship dem build am on " shared interest and strong pipo-to-pipo waka come ontop im want make dis links continue to dey stronger under Bola Ahmed Tinubu govment. Di two also discuss why e dey important for di leadership for Bola Ahmed Tinubu govment to represent all Nigerians and to promote security cooperation and policies wey go support economic growth. Dis call between Blinken and Bola Ahmed Tinubu dey occur less dan two weeks to di swear-in. According to Tunde Rahman, wey be Bola Ahmed Tinubu talk talk persin, na di US diplomat initiate di conversation wit di president...

Gunmen don kill two US Consulate Staff, burn dier body inside Anambra state

Image
Tori As We Dey Waka Come: Gunmen don kill two Nigeria pipo wey dey work for US Embassy, dem born dis pipo body inside Anambra state today May 16th 2023. Some staff of di US Embassy for Nigeria don kpai after dis unkown gunmen kill dem burn dier body for Ogboru LGA of Anambra state  Dem shoot dis officials dead as dem dey waka on top dier humanitarian mission for dis area. Di talk talk person for US mission for Nigeria yan say olopa dey di Nigerian security men to fit waka do di investigation  Di talk talk person for of di state police command, DSP Tochukwu Ikenga, don confirmed dis statement. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.