Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident"

 Tori As We Dey Waka Come:



Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident" wey involve tori pipo, one talk talk persin to di prince confam.


Di mata happun afta di Duke and Duchess of Sussex attend one award ceremony for New York on Tuesday.


For inside statement, di prince talk talk persin say di "continuous pursuit" bin last ova two hours.

Dem add say e remain small make dia motor jam oda drivers for road, pipo wey dey waka come and police officers.

Di talk talk persin say, "even though to be public figure dey come wit some interest from di public, e no reach to cost anybody safety".




Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 

If you get Tori, send am to we Email: 

wakacometv@gmail.com 

As We Dey Waka, No Be Lie. 


Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo