Posts

Showing posts from January 13, 2021

America government should copy from Nigeria in Democracy.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis na why we before before presido, oga GoodLuck Jonathan, Be peace, Ambassador. After di 2015 election, oga Jonathan accept defeat and him congratulate him opponent.   Na 2011 be di Di First Election, wey dem elect Oga Jonathan as Vice President, den him kon enter as president after him sitting President wey be Umaru Yar'Adua pai. Oga Jonathan waka to enter for presido office again, but di waka no work as him opponent wey be  Muhammadu Buhari, defeat am for 2015. Oga Jonathan since den don dey waka go many African kontri for peace mission and election observation across Africa. One of him new appointment na with ECOWAS, wey dem send am go Mali. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Covid19: UK Close Airport on lockdown.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Coro dey disturb UK no be small, as dem don start to dey check who and who go fit enter dem Kontri Last week na him di Prime Minister yan say di government dey on national lockdown. "From 4am on di 15th of January 2021, we go dey introduce pre-departure testing requirements for every body wey dey waka enter England. All di pipo wey dey waka come on top water, and railway, dem go get prove say dem no get covid19, dis pipo go don do test 3days before dem start to take come UK." Di advice wey dem get for pipo wey dey torchlight how dem go take waka enter UK, make dem sidown for house, make dem no plan to do any waka at all. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome