Posts

Showing posts from January 3, 2021

Tori been comot on Sunday say Tinubu catch covid-19.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Tori wey waka say Bola Ahmed Tinubu don catch Covid-19, the tori wey waka come, surprise every body for we country wey hear the matter, but no be the true yan be that.  Bola Ahmed Tinubu spokes person, Tunde Rahman, say di tori wey bin comot on Sunday say Bola Ahmed Tinubu catch covid-19, and say dem don carri am go France for treatment since December, na lie from di pit of hell.  According to di statement, true true di APC chieftain dey abroad. E come talk say "we don do covid-19 test on am, 15 times, wey im travel and im fit mix up with pipo.... "Asiwaju dey very ok and him dey fine, e no get covid-19" na so Mr Tunde tok. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Schools go reopen in Rivers, 4th of January 2021

Image
Tori As We Dey WakaCome : School resumption 2021: Schools go reopen for Rivers and Bayelsa, dis January. Public and private schools for Rivers State go reopen for normal academic activities on Monday 4th January, 2021. Dis na according to statement from di State Ministry of Education wey di Permanent Secretary, Sir Chidi Adiele, sign. The tori different from di 18th January 2021 date wey Federal Government bin give for schools to reopen across di kontri, amidst dere plan and preparation against di second wave of di Covid-19 pandemic. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

See why school fit no open this January 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  this na why school fit no resume this January 2021. According to the report from Africa CDC, them yan talk say, another new wave, wey dem call second wave of the virus, don dey waka inside we country Nigeria. Na the head of Africa's Centre for Disease Control, na im yan this one. Africa Centers for Disease Control and Prevention dey assess whether the vaccines wey dem produce go still dey effective for we body. Dem talk say, wetin we need to focus on na the measures wey go fit prevent transmission of COVID, and social distance. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

Omah-Lay get Artist Twin Broda?

Image
Tori As We Dey WakaCome: controversial and trending 9ja artists, Omah-Lay don see him twin brother for we entertainment music industry, this him lookalike twin broda self dey sing well well like him and Kiss Daniels. Him name na Dimmybuoy , and him just drop new gbedu wey him call am " ARREST ME" . Even plenty reporters and celebrities dey mistake am for Omay Lay for live events. Dis matter na im dey we mouth, and other celebrities. Omahlay & Dimmybuoy, abeg na who be who for we music industry???. Send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome