Plasings

Access Bank CEO Don die for inside Helicopter, with Wife and son.

Prent
TORI AS WE DEY WAKA COME: Di CEO of Access Bank Don die for inside Helicopter wey crash with him wife, son and other crew members wey dey inside, dis na sad news to Nigeria pipo, as Tori waka come on Saturday evening inside Barstow, California. Wan American authorities confam say one helicopter wey carry six pipo crash for California. Na sad news for Nigeria and Africa banking industry. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Nigeria vs Ivory Coast go play final on Sunday.

Prent
TORI AS WE DEY WAKA COME: Nigeria vs Ivory Coast on Sunday final  Nigeria Super Eagles go waka come final play with Ivory Coast on Sunday 11th of February 2024, congratulations to we super eagles of Nigeria, do Giant of Africa as dem waka enter final on Sunday to play Ivory Coast.  Na only Egypt, Cameroon and Ghana don appear for more Afcon final pass Nigeria. Dis final dey come ten years afta Sunday Mba score di winning goal against Burkina Faso to give di Super Eagles dia third title for South Africa for 2013. Many sabi pipo dey tip dem to lift di cup dis weekend based on dia experience and di talents wey dey dia squad. Di reigning African footballer of di year Victor Osimhen dey lead di Super Eagles attack while William Troost-Ekong dey lead di defence. Congratulations to we super eagles of Nigeria Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

help me na woman I be, I no be man

Prent
TORI AS WE DEY WAKA COME: Help me na woman I be, I no be man No Man Wan waka talk to me or date me, Dem bi dey Think say I be woman wey change to man, because of the bear bear wey full my face, this matter don tire me, make I no go injure my self, no man Want marry me, no body waka come toast me, I no happy at all.  waiting make I do, I don ture for this matter, na so so look them they look me like say I be man, them no want follow me waka or talk.  Na woman I be, I no be man, waiting make I do now. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

oladipupo reis song title Jesus dey every where

Prent
Jesus dey every where song by Evangelist Oladipupo  CLICK TO PLAY:   Jesus dey every where

Rufai Oseni and Jesutega Onokpa gbas gbos wotowoto wahala on top Arise news

Prent
Tori As We Dey Waka Come with Rufai Oseni gbasgbose wahala with Jesutega Onokpasa on top Arise News. As we dey waka, no be lie. This page does not support violence   Rufai Oseni Video

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don officially become become di 16th President of Nigeria.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: E swear im allegiance and promise to deliver im duties and perform im functions in accordance wit di constitution of Nigeria and di law. E say im go abide by di code of conduct and no go allow im personal interest influence im official conduct or decision. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Subomi Balogun way be di founder of FCMB Bank die for London Friday Morning

Prent
 Tori As We Dey Waka Come: Di founder of FCMB Bank don dai Subomi Balogun way be di founder of FCMB Bank die for London Friday Morning Di founder of FCMB Bank Mr subomi Balogun way just celebrate Im 89th birthday dis March Him na ICOBA for IGBOBI COLLEGE and  him study law for London school of Economics Mr Subomi Balogun practiced as a lawyer for regional justice ministry and also for federal ministry of justice until di 1966 coup. Na after di coup Mr subomi Balogun waka enter into banking way him join di Nigerian Industrial Development Bank (NIDB) Na 1979 him established FCMB after him don waka venture into several commerce and economics firm Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Obodo Oyinbo Museum Wey Waka Come Carry Ghana Gold For Asante Don Yan Say Dem Go Like Borrow Am Back From Asante Palace

Prent
 Tori As We Dey Waka Come: Di ruler of Ghana Asante pipo don ask British Museum to return gold items wey dey dia hands to im kontri. Di Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, recently meet di museum director Dr Hartwig Fischer for discussions. Di items wey dey di museum hand include work wey di British take from Asante palace for Kumasi during war wit di British for 1874. Di British Museum tell tori pipo say im dey "explore di possibility of borrowing di items" to Ghana. Di Ghana ruler meet Dr Fischer last week, afta im di Coronation of King Charles. Ghana goment don set up Restitution Committee to torchlight di returning of items wey dem take from Asante Palace wey now dey for different pipo and institutions hand around di world. Nana Oforiatta Ayim, wey dey di committee, tell tori pipo say: "Dis objects na mainly sacred ones and dia return no be just about restitution. Na also about reparation and repair, for places wia dem from take dem, but also di pipo wey do di taking.&

Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident"

Prent
 Tori As We Dey Waka Come: Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident" wey involve tori pipo, one talk talk persin to di prince confam. Di mata happun afta di Duke and Duchess of Sussex attend one award ceremony for New York on Tuesday. For inside statement, di prince talk talk persin say di "continuous pursuit" bin last ova two hours. Dem add say e remain small make dia motor jam oda drivers for road, pipo wey dey waka come and police officers. Di talk talk persin say, "even though to be public figure dey come wit some interest from di public, e no reach to cost anybody safety". Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Nigeria President Elect: Bola Ahmed Tinubu on phone call with Anthony Blinken Di US Secretary of State.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di United States Secretary of State Antony Blinken emphasis im commitment to continue strengthen di relationship between Nigeria and im kontri for di new govment wey go soon enta office. Oga Blinken give dis assurance during im first official phone call to Nigeria president-elect Bola Ahmed Tinubu on Tuesday. Di Secretary yan say US-Nigeria relationship don go way back and say dis relationship dem build am on " shared interest and strong pipo-to-pipo waka come ontop im want make dis links continue to dey stronger under Bola Ahmed Tinubu govment. Di two also discuss why e dey important for di leadership for Bola Ahmed Tinubu govment to represent all Nigerians and to promote security cooperation and policies wey go support economic growth. Dis call between Blinken and Bola Ahmed Tinubu dey occur less dan two weeks to di swear-in. According to Tunde Rahman, wey be Bola Ahmed Tinubu talk talk persin, na di US diplomat initiate di conversation wit di president

Gunmen don kill two US Consulate Staff, burn dier body inside Anambra state

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Gunmen don kill two Nigeria pipo wey dey work for US Embassy, dem born dis pipo body inside Anambra state today May 16th 2023. Some staff of di US Embassy for Nigeria don kpai after dis unkown gunmen kill dem burn dier body for Ogboru LGA of Anambra state  Dem shoot dis officials dead as dem dey waka on top dier humanitarian mission for dis area. Di talk talk person for US mission for Nigeria yan say olopa dey di Nigerian security men to fit waka do di investigation  Di talk talk person for of di state police command, DSP Tochukwu Ikenga, don confirmed dis statement. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.