Carter Efe use Portable do suya o! officer wo's dey yan
Tori As We Dey Waka Come: As E Dey Hot! E be like say Wahala no dey finish for Zazuuu master o! Yes o, na Portable we dey talk! Dem carry am go boxing ring for Chaos in the Ring 4 last weekend for Balmoral Hall, Lagos. Dem say make him fight Carter Efe — dat skit maker wey tall like NEPA pole! Chai! Kasala don burst! Carter Efe use Portable do suya o! All three judges talk say 30-27, 30-27, 30-27. Clean mouth! No argument! Portable wey dey shout “I be street” since, body come tell am say gym no be beans . By round two, him hand don dey shake like person wey cold catch. Round three, gbim — stamina finish! But wait, na di gist wey sweet pass be dis: Afta di fight, Officer Woos come online come drop bomb! Him talk say, “ No musician support Portable… ahnahn why now? ” Ha! Social media scatter! People come dey ask: “Shey na because Portable don too fight everybody for industry? Shey na because him don yab Olamide before?” Food for thought o! Meanwhile, Carter Efe dey ...