Fifa president Gianni Infantino dey plenty pressure for di past few weeks wit some unpopular decisions im take for di football body.
Tori As We Dey Waka Come:
Fifa president Gianni Infantino dey plenty pressure for di past few weeks wit some unpopular decisions im take for di football body.
Fifa bin propose controversial lan to sell minority stakes for di World Cup to private investors, but dem face ogbonge backlash, wey force Infantino to cancel dat proposal.
European associations and Uefa bin strongly reject dis proposal wey dem tok say di World Cup gatz dey protected – no be business wey dem go sell to make profit.
Infantino bin offer all do associations $40m if dem support di proposal for private investment into di tournaments, through new subsidiary, FFE.
Inside Fifa itserf, im get support from some of di council members for dis proposal even though pipo like Luis Figo bin ask am to resign.
"Infantino don scata di office im promise to elevate, now ibi too late to save im dignity, but e no dey too late to save football."
Gianni Infantino don apologise for di "error" ova di controversial plan.
Inside one letter to Fifa Vice presidents, council and 211 member associations, Infantino and Fifa secretary general Mattias Grafstrom tok say dem dey "sincerely apologise for di errors and commit say dem no go happun again."
Di 56-year0old dey set to fight for re-election for fourth term – opponents gatz put dia names forward by 18 November.
Di election go happun for di Fifa congress for Morocco for March 2027, but bifor dat, di tension between football associations around di world and Infantino still dey hot.
English FA and odas bin withdraw dia support for Infantino
Many football federations and associations don withdraw dia support for di 56-year-old Swiss.
Di English and Welsh associations don formally withdraw dia support for Infantino.
Bifor di kasala ova di failed proposal to sell stakes for di World Cup to private investors, di English FA and di association of Wales bin write letter to support Infantino to stand for election for di 2027 Congress.
Di FA make am clear say Infantino no longer get dia support, same tin wit Welsh association.
"Di recent failure for good governance, leadership and values and sound judgment bin lead us to dis position wia Infantino don lose di confidence of di FAW to remain in control of world football."
Dem add say "failure to put di best interest of football first, na failure we no fit accept."
Serbia, Sweden and odas bin confam dia withdrawal of dia support for Infantino.
Fifpro wey be di global players' union also fire di Fifa president ova di mata.
More associations dey ready to withdraw dia support from di 56-year-old Swiss, but no be every association wey dey against am, some bin still dey support am.
As We Dey Waka, No Be Lie.
For Advert email us
E:mail wakacometv@gmail.com

Comments
Post a Comment