Posts

Showing posts from January 11, 2021

ASUU waka on top Covid-19

Image
Tori As We Dey Waka Come: Some staffs for UNILAG carry waka on top covid-19 yesterday on Sunday, after dis waka, dem say di skul never ready to open. ASUU waka yan say, dis Corona Virus, don pai pipo and Di matter don come Up to 99,063 and 1,350  on Saturday. Universities across Nigeria go begin get ready and prepare to return to school from di 18th of January, 2021. Dis na sake of say various school management don dey set time wey new academic session go begin for dis year 2021. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ritualists don confess to Police Command Osun State, say dem dey strangle pipo to death wey dem catch to do ritual. Di Osun State Police Command catch some ritualists, wey confessed say dem dey kill pipo dey sell part of di body. One of dia customer wey olopa catch, him name na Lukman Garuba, him confess say, him dey buy human body part, from dis ritualist, for N2000. Na inside Iwo, for Osun State Police catch 31 years old Garuba, dem arrest am for di place wey dis ritualists’ dem dey do dia evil work, inside town with Tajudeen Monsuru, and dem also 25 years old Hamsat Akeem, him follow confess say dem follow waka to pai one person wey him name na Akanbi Adeolu. One Monsuru confess say him kill him girlfriend, Mutiyat Alani and Akinloye Ibrahim and many other pipo.  Di Osun State Commissioner for Police, Wale Olokode don talk say very soon dem go catch all dis bad pipo wey dey do kidnapping, cultists, and drug dealing dem. www.wakacometv.blo...

Nigeria Immigration Service Catch Fire.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Fire don catch Nigeria Immigration Service Headquarter for Abuja. Yesterday Fire catch parts of the headquarters of the Nigeria Immigration Service (NIS) for Abuja, the fire start early mo mo yesterday.   Dem yan as di matter take start on top twitter, dem talk say, di fire affect some of di office, before Fire Service waka come, help dem quench am. FIRE burn inside Kugbo Furniture Market, Asokoro Extension, Abuja yesterday. Di fire happen around 6:00a.m. before the Fire Service waka come quench am. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome