Posts

Showing posts from May 16, 2023

clubs wey fit qualify for Europe Premier league

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Sport Waka Di Champions League race bin look settled but Liverpool seven straight wins don drag dem back enta di race again. Manchester City and Arsenal already dey guaranteed to finish for di top four and Newcastle and Manchester United dey most likely to join dem dia. But, Liverpool now dey one point behind we no say dem don play one game more dan di Magpies and Red Devils. pipo no think say e dey possible but if dem slip, we gatz dey dia," manager Jurgen Klopp tok. "Dem go slip? I no know. We fit win both games? I no know." Di teams wey finish for di top seven go secure European football next season anchester City, wey fit win di Champions League dis season,  and Arsenal, wit dia current totals of 85 and 81 points respectively, go finish as di top two. City go win di league if dem beat Chelsea on Sunday (16:00 BST). Newcastle and Manchester United occupy third and fourth place respectively, na only goal difference dey separate dem, on 66 poi...

See As Person Pikin And Im Friends Die When Dem Drink Zakami Drink Inside Wedding

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Na on Di 7th of May on Sunday 2023 na di date wey go linger for di minds of Sheka residents for Kano state, afta wedding celebration turn ugly. Just like e dey happun for many cultures whenever pesin dey celebrate, family and friends dey follow am jolificate di moment. As one groom and bride dey celebrate dia wedding day on dis day, friends of di groom gather to follow am jolly as dem no know say dem go kpai after dis enjoyment. Some pipo for Sheka area say na up to 10 friends die afta dem organise local tea drinking competition to celebrate dia friend. Di drink na Zakami as dem dey call am for Hausa, na very strong drink wey many pipo dey avoid as dem say e get side effects wey no good for body. Mallam Abdullahi Mahmoud lose im 22 years old pikin, Mubarak for di incident and e tell tori pipo say e dey suspect say anoda tin fit dey inside di Zakami drink wey lead to deaths. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:...