See As Person Pikin And Im Friends Die When Dem Drink Zakami Drink Inside Wedding

 Tori As We Dey Waka Come:



Na on Di 7th of May on Sunday 2023 na di date wey go linger for di minds of Sheka residents for Kano state, afta wedding celebration turn ugly.

Just like e dey happun for many cultures whenever pesin dey celebrate, family and friends dey follow am jolificate di moment.



As one groom and bride dey celebrate dia wedding day on dis day, friends of di groom gather to follow am jolly as dem no know say dem go kpai after dis enjoyment.

Some pipo for Sheka area say na up to 10 friends die afta dem organise local tea drinking competition to celebrate dia friend.



Di drink na Zakami as dem dey call am for Hausa, na very strong drink wey many pipo dey avoid as dem say e get side effects wey no good for body.




Mallam Abdullahi Mahmoud lose im 22 years old pikin, Mubarak for di incident and e tell tori pipo say e dey suspect say anoda tin fit dey inside di Zakami drink wey lead to deaths.





Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 

If you get Tori, send am to we Email: 

wakacometv@gmail.com 

As We Dey Waka, No Be Lie. 


Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo