Posts

Showing posts from May 15, 2023

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Nigerian chef: Hilda Baci don breaks Guinness World Record for ‘longest cooking time. Di Nigerian chef, on Monday morning waka smashed Di 87 hours 45 minutes record wey Lata Tondon former Guinness World Record holder Break dat time. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.

Veteran Nollywood actor, Obinna Nwafor, popularly known as Saint Obi don kpai at di age of 57

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Veteran Nollywood actor, Obinna Nwafor, popularly known as Saint Obi don kpai at di age of 57, on Saturday evening. Him death waka come as shock to plenty pipo on Saturday evening. In 2001, Saint Obi, produced him first movie titled Take Me to Maama,him name bi Jerry inside di feem,  alongside Ebi Sam, Rachel Oniga, Nse Abel and Enebeli Elebuwa. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

YORUBA Movie Producer Actor Murphy Afolabi don kpai

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Nigeria Yoruba Nollywood actor wey dey make pipo happy for inside im film don kpai, him dey very popular for di movie industry, him name na Murphy Afolabi don die at di age of 49. Di Chairman of di Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan confam im death. Oga Amusan wey pipo sabi as Baba Latin say im just receive di news and neva sabi di cause of im death plus oda details. Murphy Afolabi death dey come just about one week afta e celebrate im 49th birthday. On im Instagram page on im birthday e pray and ask God for wisdom and knowledge to do im will and to live a righteous life. Na Who be Murphy Afolabi: Oga Murphy Afolabi na popular actor, director producer. E dey popular for Yoruba films, him don feature for plenty movies. na on di 5th of May, 1974, dem born am, enever tey wey him do him 49th bitrday. Na Osun State for Oroki Asala inside Osogbo him waka come from, him get Diploma in Theatre Arts and Fi...

Onidimu Of Idimu wey be di Lagos Monarch don kpai.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Onidimu Of Idimu wey be di Lagos Monarch don kpai. Di Onidimu of Idimu Land inside Alimosho Local Government Area of Lagos State, Oba Azeez Olugoke Don Kpai, him don waka join im ancestors. Na on Sunday Di Chairman of Egbe Idimu Local Council Development Area, Sanyaolu Olowoopejo yan dis mata say monarch Kpai at di age of 87 Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Police Don Arrest Di Oga Of Kidnap Kingpin for Delta State

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Di Delta State Olopa Public Relation Officer, DSP Bright Edafe, talk dis mata for inside wan statement. Olopa Yan say james carry di waka enter Ujewu Community insisde Udu Local Goverment Area on Friday, him waka arrested Di Syndicate Driver,  Peter wey be Native of Kokori community for Ethiope-East LGA. According to DSP Edafe, Dem confessed to their involvements in series of armed robbery, kidnapping operations in Ughelli and Warri  with di kidnap of Mr and Mrs Okutonye Efetobore on 27/04/2023, inside Ughellli town and dem waka collect one million naira (N1,000,000) before dem released couples. Na on di 12/05/2023, di suspects waka with olopa to another notorious member of their criminal gang wey guy name na “Oh Lord” inside Egbike area in Udu. Di suspect do wahala, when him see olopa with him Gun,as him take run comort for him  carban with bullet injuries. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email: ...

Kastina Senator, Don Elect Back Akpabio Barau.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: 10th senate presidency dem for kastina senator, don elect back Akpabio Barau. Dis waka happen for Katsina Governor’s Lodge, Asokoro, Abuja, on Sunday, May 14, 2023. Di lawmakers-elect dis waka on top dis mata. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

160 women stranded for Sudan without Nigerian passport

Image
  Tori As We Dey Waka Come: 160 women wey say them be nigerian don dey stranded for sudarn without nigerian passport Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

Nigerian Jollof Queen, Hilda Baci go soon collect Guinness world record ontop food

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Lagos State Govenor Sanwo olu waka go see Di Nigerian Jollof Queen,  Hilda Baci, wey dey cook plenty food to fit collect the guinness world record ontop food Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

SEUN KUTI DON ENTER WAHALA FOR OLOPA MATA

Image
Tori As We Dey Waka Come:   Oga of Dem Olopa don call for di arrest of Nigerian Afrobeat singer, Seun Kuti over alleged assault olopa. IGP Usman Alkali Baba direct di commissioner of police for Lagos state to sharparly arrest di musician after one viral video show am wia im dey assault one olopa. Seun, 40, son of lengendary activist and musician Fela Kuti inside di video slap di officer wey dey in uniform while pipo watch inside dia moto. Inside statement on Sunday night, di oga kpatakpata of olopa for Nigeria ''order for di full investigate into di remote and immediate cause(s) of di assault and prosecution of di suspect accordingly.'' E no dey clear wetin cause di wahala but Oga Kuti for one Instagram post claim say di officer bin wan ''kill me and my family''. Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.