Posts

Showing posts from January 23, 2021

Gunmen attack Dutsin Gari Village and others

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di villages gunmen attack na Dutsin Gari, Asha-lafiya, Rayau, Munkuru, Mahunta and Talli. Maigari yan say di residents of di affected villages want make government help dem. Matawalle yan to the community pipo say, make dem no worry say him and him pipo go helep dem. Him say him dey worry ontop di matter wey happen, say him no happy at all, and him dey feel serious pain ontop the matter. “I assure you that I will do everything within my powers to make sure that you go back to your respective villages." Him yan Him talk as him go make sure say dem dey okay and every body dey safe for dia villages. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

IGP Adamu don confirm di arrest of Sunday Igboho.

Image
Tori As We Dey Waka Come: IGP Adamu don confirm di arrest of Sunday Igboho. Di Inspector General of Police, Mohammed Adamu don order di arrest of Sunday Igboho over ultimatum to Fulani herdsmen Inspector General of the Nigeria Police, confirm say him arrest Igboho come abuja, to face prosecution. According to him, Igboho dey part of the people wey say make fulani herdsmen pipo comot for di land. Igboho yan last week Friday say him give fulani pipo seven days, make dem leave Oyo state because dem dey kill pipo any how for forests. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Court sentence 52years old man, wey steal, Infinix Phone.

Image
Tori As We Dey Waka Come On Friday inside Ogun state, one Court waka sentence, one man wey go steal infinix phone, dis man name na Usman Abfullahi, him be 52 years old. Di Magistrates’ Court talk say make dis man go spend three months with Community Service inside prison. Di name of di person wey sentence di man go prison na Magistrate Dehinde Dipeolu, but dem say di man dey beg dem say na devil hand work be dis, him say make dem pity am, as him be old man, him say make dem forgive am say him no go do am again. Di police man wey catch am, talk inside the matter, him tell di court say na on di 19th of January, around 2pm, for Panseke area inside Abeokuta, dis man run enter Ibrahim Ogudipe shop, wey bi computer operator, him tell am say him wan buy Infinix hot9, for him hand, e no finish for dia, him enter another shop of Oluwasegun Olorunmade wey be tailor,  E lie for dis tailor aay him need to arrange cloth for am, na so him take carry phone waka dey go. www.wakacometv.blo...

COVID19: British Prime Minister Boris Johnson Don Para Give U.K OnTop Dis New CoronaVirus.

Image
  Tori As We Dey Waka Come: British Prime Minister Boris Johnson don halla on Friday, to government pipo inside U.K, say dis new coronavirus go dey kill pass before own, dis na di matter wey him see on top dis second wave of coronavirus, make dem take action to dis matter, dis no be small matter at all wey dem go dey use play, as di coronavirus never get medicine wey fit remove am for person body. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Luton Shelton Former Jamaican Footballer don die

Image
Sport-Waka: Luton Shelton Former Jamaican Footballer don die at 35.  Dem bin diagnose am with amyotrophic, na on top dis matter him die, him bin get moto neurons disease wey make am retire to dey play ball in 2018. Plenty pipo don cry say dis former striker die, him padi dem wey play ball with am self dey cry on top dis matter, dem no happy at all. Him don play ball for plenty club and him score 35 goals for him country, Jamaica. Him play 25 times for blades, after him play finish for Helsingborg inside sweden, him score four times inside 21 games www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #sportwaka

Legit COVID-19 medicine don finally Waka Come outside for Isreal.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Israel na di oga for all di world now, as dem don carry waka come with di medicine wey dey remove coronavirus for person body. On top dis same matter, United States of America don do plenty waka to helep for COVID19, still e no work, but Israel don get medicine wey go remove coronavirus kpatakpata. Since January 19, 2021, 25.6% of di pipo wey dey Israel don collect dis medicine, wey dey remove coronavirus for body di number of pipo wey don collect am now na 550,000 pipo. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Nigeria President Don Warn FIRS, Make Dem No Dey Look Uche Face To Collect Money.

Image
Tori As We Dey Waka Come: President Muhammadu Buhari yesterday yan say, make di Federal Inland Revenue Service (FIRS) and other agencies, no dey play with money matter, say make dem dey collect tax money from all di foreign companies wey dey work inside Nigeria. Him talk dis matter inside Abuja, State House, say make dem dey waka sharp sharp on top tax matter. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Google and Facebook go waka comot for Australia.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Google and Facebook go waka comot for Australia, if di government put am for law, say make dem dey pay pipo money. Google don talk say, dem go comot for Australia and dem go block every body wey dey Australia for Google, if di government confirm say dem go dey pay pipo money for dia business ontop google. So Australia government go soon put am for law say, make google and facebook dey pay pipo money for wetin pipo get to dey do ontop dia site. Google yan say dem go block news reporter wey dey use dia google site to dey torchlight matter. country no go fit dey browse on top google again to search for news from Australia, and Australia no go get news online again if dem block Australia. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome