Posts

Showing posts from January 25, 2021

OPC warn President Buhari and Fulani herdsmen

Image
Tori as we dey waka come: OPC warn President Buhari, say dem support Sunday Igboho. Dis Sunday na him Di Oodua pipu warn president Buhari say, dem no dey joke ontop dis matter at all, as him don make am clear say him dey support dis herdsmen wey dey enter villages dey kill pipu, dem say dis na warning, make dis herdsmen waka comot from yoruba kingdom. Mr Wasiu Afolabi, Deputy President to the late OPC Founder, Dr Fredrick Fasehun, yan say, no Southerner go waka enter North go dey kill pipu, but why dis northern pipu dey enter pipu zone dey kill kill, and Nigeria President no dey yan ontop dis bad waka. OPC talk inside Sunday Igboho matter, say na good thing Sunday waka do, to protect yoruba kingdom, say dem support Sunday, and make dem free Sunday from any arrest. Odua pipu don halla give President Buhari say make him stop to dey take side on top dis killing wey herdsmen dey kill kill innocent pipu for insde dia land, Oodua don come outside with Amotekun to fit stop dis bad pipu wey de...

Sunday Igboho: Fulani Herdsmen Dey Plan War

Image
Tori as we dey waka come: Yoruba's don Fem Governor of Oyo state, say him no dey support the safety and security of Yoruba land but him dey play on top dis matter, for him own political ait. Sunday Igboho, don dey rain for news, as him help to secure and stop bad pipo wey dey kill innocent pipo inside Yoruba land. Him bin give fulani pipo wey dey kill pipo inside bush, seven-days make dem carry dia self comot for Yoruba land, as dem no sabi good thing to do, dan to dey kill and kidnap pipo inside forests. Oyo State Governor, don yan on top dis matter say, no be Fulani pipo dey kill pipo. Mr. Igboho Sunday Na October 10th 1972, dem born am, inside Igboho town, for Oke-Ogun, Oyo State. Na youth activist for Yoruba land him bi, but some pipo dey yan about am say Na politician dem sabi say him bi.   The whole of YORUBA Kingdom dey vex with President Buhari and the IGP wey say make dem arrest Sunday Igboho, dem talk say Sunday Igboho dey do better waka to help secure Yoruba land f...