Sunday Igboho: Fulani Herdsmen Dey Plan War

Tori as we dey waka come:

Yoruba's don Fem Governor of Oyo state, say him no dey support the safety and security of Yoruba land but him dey play on top dis matter, for him own political ait.

Sunday Igboho, don dey rain for news, as him help to secure and stop bad pipo wey dey kill innocent pipo inside Yoruba land.
Him bin give fulani pipo wey dey kill pipo inside bush, seven-days make dem carry dia self comot for Yoruba land, as dem no sabi good thing to do, dan to dey kill and kidnap pipo inside forests.

Oyo State Governor, don yan on top dis matter say, no be Fulani pipo dey kill pipo.

Mr. Igboho Sunday Na October 10th 1972, dem born am, inside Igboho town, for Oke-Ogun, Oyo State.
Na youth activist for Yoruba land him bi, but some pipo dey yan about am say Na politician dem sabi say him bi.
 
The whole of YORUBA Kingdom dey vex with President Buhari and the IGP wey say make dem arrest Sunday Igboho, dem talk say Sunday Igboho dey do better waka to help secure Yoruba land from herdsmen wey dey kill pipo inside bush.

Di wey Oga of police arrest Sunday Igboho dey make Yoruba pipo dey parra for am, dem say police no dey help for fulani herdsmen matter, and dis herdsmen dey kill innocent pipo, but Sunday dey fight for Yoruba land to help protect dem from dis herdsmen wey dey kill pipo, dem say e no good as oga of police take arrest Sunday Igboho at all, and dem con finally say Sunday na dem hero wey dey help for security matter.

Wan person yan on top twitter aay, dis matter no good as IG of police arrest Sunday Igboho wey dey help to secure di pipu, say na police work be dis but, police no dey catch herdsmen at all, dem dey look dem as dem dey enter bush dey carry Ak47 dey kill pipu, dis person yan say as di matter bi now, if person protect himself to secure him family, E no dey bad at all, him say na so oga of police take look wan shettima for north, wey come outside say make Igbo pipu comot for Hausa land, oga of police no arrest that person that time, dem say na because di person na northerner, and dis herdsmen self na from north, dis man wey him name na Temidayo Adesina parra well well ontop dis matter, him say oga of police dey do tribalism and nepotism, him no supposed to arrest Sunday Igboho at all, wey dey help to protect di pipu, na security work him dey do as police no dey see wetin herdsmen dey do as bad thing.



www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.
As We Dey Waka, No Be Lie.
#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.