Posts

Showing posts from October 30, 2022

Nigeria Navy waka with NAPTIP Rescue 50 girls from Ashawo Trafficker pipu hand.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Di Nigeria Navy on top water don waka rescue 50 women from ashawo waka, on top dis matter as e dey hot, dem don arrest 3 pipu wey dem dey suspect say na ashawo International waka, dat wan wey oyinbo dey call sex traffickers inside Port Harcourt. Lt.-Cdr. Richard Iginla, Base Information Officer, Nigerian Navy Ship (NNS) Pathfinder, do did waka to rescued dis victims for PH city on Sunday. Iginla yan say did waka join body with Nigeria Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) and the Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC). According to Iginla, inside Dis 50 Ashawo teenage girls follow dey inside wey dem  rescued, early mormor on Saturday. Dem yan say na with di help of NAPTIP, wey give dem dis information, because dem self don dey do investigation on top di matter, with small pikin of  14 years of age. Na 50 young girls dis traffickers forced into ashawo work, that wan w...

Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball for penalty shootout

Image
Tori As We Dey WakaCome:  On top we sport waka with Nigeria Under 17 women. We Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball wey make we kuntry win Germany for bronze medal  We Nigeria’s U-17 Women’s team, Flamingoes give Germany wotowoto on top penalty, we dem use collect bronze medal inside dis FIFA U-17 Women’s World Cup sport waka, dem give 3-2 dem give Germany ontop penalty we dem play. We Nigerian Flamingoes bin dey 3 goals before Germany waka draw with dem, na dis draw we dem two enter make dem play penalty. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Danfo Bus for lagos Go waka Protest on Monday, dem go Boycott work - Dis na why

Image
Tori As We Dey WakaCome: All di commercial driver for lagos state don yan  say, dem go waka for seven days protest. According to dem, Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state. Dem waka come with di Joint Drivers' Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend. Wan person wey be JDWAN too say dem dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management. Dem National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state. WATING DEM DEY ASK FOR  Bus drivers for Lagos say dem ...