Posts

Showing posts from February 23, 2021

Orlu crisis: Nigerian Army send helicopter go Orlu.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Military dey do air strike for Orlu as we dey see inside dis video Nigeria Military helicopter go Orlu town, for Imo State, southeast of Nigeria. Three weeks ago, jaguda pipo do shooting for di area kill pipo and burn some houses. E dey on top all social media for Nigeria on top dis matter wey dey hot for Orlu, some local tori pipo dey report say Nigeria Military dey conduct air strikes for Orlu as dem dey try catch members of Eastern Security Network (ESN). Different video of this matter dey sup on top twitter, Instagram and Facebook.   Helicopter fly pass dem as e fly out of di view of di video you fit hear gun shot. One man voice dey shout, "ha! Jesus Christ o! wia dis one dey? Ha! Why dis pipo dey waka upandan abeg? Why dis pipo dey… Jesus see gun. Ha!... make everybody enta... See di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wa...

Breaking News: Mysterious Death of National Open University Nigeria (NOUN) Student.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say im be Fatimah Papa, Mr Adisa Kehinde  Ashimolowo dey stay for Ibadan, with Fatimah wey be him first daughter. Im say dem call am on top phone say im daughter fatimah waka go write exam on di 17th of February in the morning and later dem call am di next day on di 18th say dem see her dead body for road Gbagada under bridge, Lagos. Him talk say di person wey see him daughter body, wey be di eye witness yan say dem no see im daughter phone with am. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo confirmed say dem bury her for Lagos inside Atan Cemetery that same day because im na Muslim man.  Di CONS National president talk to Mr Adisa Kehinde Ashimolowo say all di students grievance for di sad news of fatimah's wey die and dem go protest. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say di students fit waka come to visit their house for *Alfa Ojuotono House, by Kulodi Market, Amuloko area, Iwo Road Ibadan, O...