Posts

Showing posts from April 5, 2021

Gunmen Attack Prison for Owerri on Monday.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Gunmen on Monday April 5th 2021, attack di Nigerian Correctional Services (NCS) for Owerri, Imo state capital for South East Nigeria. According to di tori, E happun around midnight and e never clear well well if prisoners escape from di prison. Na About 30 vehicles na im di gunmen burn down inside di police headquarters wey dey di same area. Di police headquarters dey opposite di Imo state government house. E no dey clear who carry out di attack at di moment. Dis no be di first time hoodlums dey attack prison officials and dia facility for Imo State. IGP for di statement wey im tok tok person CP Frank Mba, release say "di attempt by di attackers to gain access to where Police dey keep dia weapons for di Headquarters fail as officers wey dey on duty no allow dem. Di place where Police dey keep dia weapons dey intact and di police no record any death apart from di Police constable wey sustain mino...