Posts

Showing posts from December 7, 2021

France pipo dey fight for road: 50,000 pipo tested positive for coronavirus

Image
Tori As We Dey Waka Come: France on Saturday Talk say dem don record more than 50,000 people wey dey tested positive for coronavirus in the past 24 hours, as on top dis COVID-19. Di amount of pipo dey increase on top say dem dey give dem vaslin, dis matter make di Government  cancel all social party, clubs, office and all, say make pipo dey work from house and say Christmas and new year party no go happened, di government also yan say make small picking dem dey use nose mask and every body wey dey do gov work, on top wan video for social media for we YouTube channel wakacometv video we go see has di pipo wey don collect vaccine dey fight pipo wey never collect, say make dem go collect am has dis number dey increase and pipo dey die everyday.   Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

12years old : Studen of Dowen College Death in details.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Thousands of pipo don sign petition on top dis matter wey happen for Dowen Collage, Lagos state Nigeria, wey some group of cult students beat dis 12-year-old Sylvester Oromoni, before him die, him dey inside hospital with him family dey yan everything wey happen and how fear no fit let am talk, di state Gov don close dis school down and di ijow pipo plus plenty Nigerian all over di world dey sign petition say make dem give justice to dis matter. E never finish as him cousin brother  yan everything him sabi on top dis matter on Twitter... - Cousin brother to  Sylvester- tok wetin im know about wetin happen. Him yan am ontop Twitter say five boys bin block Sylvester, lock am for im hostel and give am one chemical to drink - nobody fit confirm wetin really happen because police neva tok anything because dem still dey investigate di matter. On top di waka officers don continue dia investigation, Sylvester father tok say im want D...

FESTAC TOWN: POLICE ENTER FIGHT WITH OKADA

Image
Tori As We Dey Waka Come: On top FESTAC TOWN. Di Tori wey cus gbege and wahala with okada and Police Task Force, dis matter cus plenty scarter scater inside featac town last week Saturday na on top so gbege we happen between,  okada and police. Olopa don dey waka since 2:30am today because of the wahala wey happeun on Saturday between okada riders and the Police Task Force.   Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.