Posts

Showing posts from January 10, 2021

Snow Wahala Inside Spain

Image
Tori As We Dey Waka Come: Snow don cause wahala for inside Spain, Dis cold wey dey fall like ice block, don cover pipo mottor plus house inside Madrid for Spain, Di matter don pai 4 pipo, Di Andalucia region emergency service don recover Di body of some pipo, wey Dis cold carry go, with di motor of dis pipo wey dis snow wash enter river wey dey near Fuengirola. 2 pipo wey no get caban to sleep, don kpai on top di cold wey catch dem outside inside snow, one of di pipo die for inside Madrid, di second person na inside eastern city of Calatayud, olopa pipo talk say dis matter Don dey sup for Iberian peninsula since 1971.  This snow matter don do plenty scatascata enter Filomena wey dey cus gbege and big wahala to thousands of pipo, wey make dem stay inside dem motor, inside train station and airport, dis snow matter continue on Saturday. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakaco...

Fraudulent Camera man

Image
Tori As We Dey Waka Come: Award winning and leading Director/Editor for Nigerian Film industry, don waka come outside to yan; him talk say one of him former worker wey him name na @fgbohunmi for Instagram, say him and him company no get any waka to do with this fgbohunmi. Dis person wey him picture dey show on top we Tori na fgbohunmi, wey dey do magomago, that wan wey oyinbo dey call fraud, on top him former boss company name, him dey use am dey check mate people to dey collect money.   Mr Tosin Igho don talk say make every body stay away from dis fraudster wey dey do bad waka on top him company name, Oga tosin yan say him no get business with this person, make any body no go do business with this @fgbohunmi with him company name, say anything wey happen him no dey. Oga Tosin yan talk say, "dis na public announcement for everybody, cos dis person wey una dey see, no get any business to do with me Tosin Igho, and remote picture, make una no go enter wahala for dis person hand, b...

Covid19: UK don Ban 11 African kontri.

Image
Tori As We Dey Waka Come: UK don extend travel ban give 11 kontri for Africa, wey dey like to waka go obodoyinbo, on top corona virus, wey we pipp dey call covid-19. Di United Kingdom yan on Thursday say, dem go extend ban to all international passengers from Southern African kontris, wey dey waka come dem kontri. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

AMOTEKUN In Action on Fulani herdsmen.

Image
Tori As We Dey Waka Come: As the matter dey hot for Oyo State, more dan seven pipo don die, on top Dis kasala wit Oyo State Security Network Agency, wey we pipo sabi as Amotekun, and some herdsmen inside Okebi village, Aiyete Area for Ibarapa North Local Government Area inside the State. Early momo as e dey hot, na him dem Amotekun carry waka, to do security parro on Saturday inside Okebi village, to look for suspected kidnappers and Fulani herdsmen wey dey hide inside Di village. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome