Snow Wahala Inside Spain

Tori As We Dey Waka Come:

Snow don cause wahala for inside Spain, Dis cold wey dey fall like ice block, don cover pipo mottor plus house inside Madrid for Spain, Di matter don pai 4 pipo, Di Andalucia region emergency service don recover Di body of some pipo, wey Dis cold carry go, with di motor of dis pipo wey dis snow wash enter river wey dey near Fuengirola.


2 pipo wey no get caban to sleep, don kpai on top di cold wey catch dem outside inside snow, one of di pipo die for inside Madrid, di second person na inside eastern city of Calatayud, olopa pipo talk say dis matter Don dey sup for Iberian peninsula since 1971. 

This snow matter don do plenty scatascata enter Filomena wey dey cus gbege and big wahala to thousands of pipo, wey make dem stay inside dem motor, inside train station and airport, dis snow matter continue on Saturday.


www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.