Plasings

Wys tans plasings vanaf September, 2021

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Prent
Tori As We Dey Waka Come:   Militry don waka collect presidential power for Guinea. Dis gbas gbos matter, sup today wey be, Sunday 5th of September 2021, inside this hot sun as e dey hot,   Di oga wey carry dis waka na LT  Colonel Mamadi Doumbouya,  na him sojias dem waka go arrest di presido wey don dey for power since December 2010.  Guinea pipu dey jubilate with happiness has dem don collect presidential power for President Alpha Conde hand. Di soldiers yan say dis presido power wey dem waka come collect by fire by force, na ontop say di kontri pipu, dey die ontop dis poverty and corruption. Na who be dis Guinea presido wey dem dey call Alpha Condé, dis man na 83 years old, dem born am di year 1938 4th of March, him be politician wey don dey for Presido power since December 2010 till now wey gbege don happen dis month September 2021, dem don waka comort am for power.   For advert and sponsorship Call 08133385379 As We Dey Waka, No Be Lie.