Posts

Showing posts from May, 2026

Carter Efe use Portable do suya o! officer wo's dey yan

Image
Tori As We Dey Waka Come: As E Dey Hot! E be like say Wahala no dey finish for Zazuuu master o! Yes o, na Portable we dey talk! Dem carry am go boxing ring for Chaos in the Ring 4 last weekend for Balmoral Hall, Lagos. Dem say make him fight Carter Efe — dat skit maker wey tall like NEPA pole! Chai! Kasala don burst! Carter Efe use Portable do suya o! All three judges talk say 30-27, 30-27, 30-27. Clean mouth! No argument! Portable wey dey shout “I be street” since, body come tell am say gym no be beans . By round two, him hand don dey shake like person wey cold catch. Round three, gbim — stamina finish! But wait, na di gist wey sweet pass be dis: Afta di fight, Officer Woos come online come drop bomb! Him talk say, “ No musician support Portable… ahnahn why now? ” Ha! Social media scatter! People come dey ask: “Shey na because Portable don too fight everybody for industry? Shey na because him don yab Olamide before?” Food for thought o! Meanwhile, Carter Efe dey ...

Portable vs Cater Efe Boxing Fight Tonight!

Image
Tori As We Dey Waka Come: Click to watch live  Play As E Dey Hot inside We country Nigeria, Portable vs Cater Efe Boxing Fight Tonight! Wahala dey o! Today na 1st May 2026, and fight wey everybody dey wait for go shele tonight! Our own Street King, Portable a.k.a Zazuu, go enter ring to face Carter Efe for one mad boxing match. Dem talk say na grudge match be this — two of dem don dey yab each other for social media tey tey. Tonight na to settle am with gloves! Where you go watch am: Wakakom TV YouTube channel go show am LIVE. No dulling, just subscribe and turn on notification so you no go miss round one. Time: Fight go start tonight. Make you dey online early make traffic no jam you. Why this fight hot: Portable talk say “I no be musician alone, I be street soldier.” Carter Efe sef reply am say “Ring no be studio o.” Na who go laugh last we go see! So if you be Zazuu fan or you just wan see gbas gbos, carry your data come. Tonight na fire for Wakakom TV YouTube! ...