South-East don Ban Cows, make dem no dey waka again for road.
Tori As We Dey Waka Come: South east Ban Cows by foot: No more Open Grazing, Umahi explain why dem ban movement of cows by foot. South-east governor don ban open grazing, di Chairman Southeast Governors' Forum, David Umahi don confirm. Governor Umahi of Ebonyi say di South-east zone ban open grazing of cattle inside dia areas Na during one APC stakeholder meeting for Christian Ecumenical Centre Abakaliki, di Ebonyi State Governor announce dis mata. Di South-east Governors' Forum also ban di movement of cows by foot into di zone and beg leaders to show loyalty to Nigeria alias patriotism for dia conduct to guarantee di unity of di kontri. Governor David Umahi say: "We dey live in a dangerous time, without patriotism to our nation Nigeria, e dey very difficult to get a peaceful time" Make leaders and stakeholders of di zone to speak up and avoid playing politics with di Security of di zone and nation. "Governors of South-east don dey cal...