Posts

Showing posts from February 2, 2021

Nigerian Army: Di Secret Execution of 6 Igbo People, Na Fake News

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian Army waka yan on top twitter, say that tori for twitter na 'fake news. Dem say na fake news, of di matter wey sup say dem do one "secret execution of 6 Igbo Christian soldiers" on 25 January 2021. For dia report, local tori pipo News Express claim say dem torchlight di report by one human rights group wey accuse di Nigerian Army of di "secret execution of 6 Igbo Christian soldiers" on 25 January 2021. Tori wey waka comot on Tuesday be say di name of di 6 soldiers na - Prince Ukwuoma, Ebube Isaiah, Amos Azubuike, Ekene Ebere, Moses Anyim and Godwin Uchendu, dem bin dey based for di Abacha Barracks, Abuja. Dem say na ethnic cleansing di Nigerian Army use di soldiers do because of dia tribe (Igbo) and dia religion (Christian). Nigerian Army on dia official Twitter handle don declare say di tori no be true, after dem write "Fake News!!!" ontop screenshot of di News Express tori for Twi...

South-East don Ban Cows, make dem no dey waka again for road.

Image
Tori As We Dey Waka Come: South east Ban Cows by foot: No more Open Grazing, Umahi explain why dem ban movement of cows by foot. South-east governor don ban open grazing, di Chairman Southeast Governors' Forum, David Umahi don confirm. Governor Umahi of Ebonyi say di South-east zone ban open grazing of cattle inside dia areas Na during one APC stakeholder meeting for Christian Ecumenical Centre Abakaliki, di Ebonyi State Governor announce dis mata. Di South-east Governors' Forum also ban di movement of cows by foot into di zone and beg leaders to show loyalty to Nigeria alias patriotism for dia conduct to guarantee di unity of di kontri. Governor David Umahi say: "We dey live in a dangerous time, without patriotism to our nation Nigeria, e dey very difficult to get a peaceful time" Make leaders and stakeholders of di zone to speak up and avoid playing politics with di Security of di zone and nation. "Governors of South-east don dey cal...

Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room. Nigerians don begin react to one video wey show face for internet wey claim say one hotel for Ogun state hide cameras for inside di rooms wey guest dey lodge. Dem also warn pipo to dey careful of di kain hotel dem go dey lodge. Di pipo wey dey dis video, para for di hotel management, why dem go install camera inside di rooms. Di men wey dey para for di video say dem discover say dem hide di camera inside Air Conditioner for dia rooms. Dem talk say di camera don record all dia family naked body. Nigeria Hotel Association say dem still dey torchlight di mata and dey try find out di particular hotel wey di thing take happun. Oga Akpovwovwo say hotels "fit install cameras for di corridor, staircase, back of di hotel but for inside rooms e dey wrong." installation of cameras for inside guest rooms dey very wrong, na invasion of guest privacy and e dey devili...

Ogun state security: Sunday Igboho help to chase out, killer herdsmen'.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Sunday Adeyemo aka Sunday Igboho address youths for Ogun state on Monday as e enta bush to go draw ear for herdsmen wey dey di state. Plenti pipo gather for Ogun state on Monday to meet wit di Human right activist, Sunday Igboho wey give herdsmen ultimatum to comot from Yoruba lands. In di past week, im bin give herdsmen for Oyo State, wey be im home state seven days deadline to leave di state on top accuse of Kidnap, rape and killings of farmers and pipo for di state. On Monday Sunday Igboho carry di campaign to pursue di herdsmen from yoruba land enta Ogun State. Im tok say Ogun state goment no want as herdsmen dey allegedly rape women for di state, Kidnap pipo and kill some of im citizens. "Ogun state govnor, kings for di state and all Yoruba pipo say dem no want make [herders] dey take over our farm, dey Kidnap us for our land disturb us, dis na why we enta Ogun State to adress di mata." Sunday Igboho charge di youths we...

Covid-19 Vaccine: Christian Association Of Nigeria, (CAN) tell President make him take am first.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Christian Association of Nigeria (CAN) talk say Dis COVID-19 Vaccination wey dem want Nigerians to take, go start from President Muhammadu Buhari and him government officials. CAN talk say make our leaders wey dey govern we kontri take am first, before we di pipu go follow waka on top di vaccination, na leadership by example, make pipu see say di vaccination good well well for body to fit take. Na on Wednesday dem talk dis matter on top Covid19 Vaccination, as President don sign for law on Wednesday, say na for we kontri and for pipu Health protection. Chairman, Christian Association of Nigeria (CAN) Lagos State chapter, Bishop Stephen Adegbite (left); Secretary to the Government of the Federation/ Chairman Presidential Task Force on COVID-19, Boss Mustapha and Executive Director, Nigerian Interfaith Action Association (NIFAA), Bishop Sunday Onuoha during a sensitisation meeting on COVID-19 vaccine introduction for Christian leaders and scholars inside Ab...

Gunmen free orphans, for Rachael Orphanage Home.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Abuja Orphanage Kidnap: Dem don free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji Gunmen dem free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji, a week after Abuja Orphanage Kidnap. Di orphans wey dem kidnap a week ago from Rachael Orphanage Home for Abaji, Abuja don get dia freedom. Di seven pikin dem wey be Elizabeth Andrew, Dayo Udeh, Jacob Ukpas, Melody Ijeh, Bernard Itim, Isaac Mathew and Laruba Emmanuel gain dia free on di 31th of January. Security Agency yan say, di pipu wey dem dey receive treatment for general hospital for Abaji sake of di way di gunmen torture dem, according to authorities. Tori wey waka come be say, on Saturday, 24th of January, around 1:00 am, plenti gunmen with heavy weapon bin attack di Rachael orphanage wey dey opposite UBE Junior Secondary School for Naharati, Abaji Area Council, Abuja. Dem bin enta through di main gate and force di gate open. Dem come rush straight to di room of di orphans com pick di ones wey dia hand rea...