Gunmen free orphans, for Rachael Orphanage Home.

 Tori As We Dey Waka Come:

Abuja Orphanage Kidnap: Dem don free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji

Gunmen dem free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji, a week after Abuja Orphanage Kidnap.


Di orphans wey dem kidnap a week ago from Rachael Orphanage Home for Abaji, Abuja don get dia freedom.


Di seven pikin dem wey be Elizabeth Andrew, Dayo Udeh, Jacob Ukpas, Melody Ijeh, Bernard Itim, Isaac Mathew and Laruba Emmanuel gain dia free on di 31th of January.


Security Agency yan say, di pipu wey dem dey receive treatment for general hospital for Abaji sake of di way di gunmen torture dem, according to authorities.


Tori wey waka come be say, on Saturday, 24th of January, around 1:00 am, plenti gunmen with heavy weapon bin attack di Rachael orphanage wey dey opposite UBE Junior Secondary School for Naharati, Abaji Area Council, Abuja.

Dem bin enta through di main gate and force di gate open.


Dem come rush straight to di room of di orphans com pick di ones wey dia hand reach- we no fit tell how old di pikins dem be.


Dem also kidnap four oda pesins from di community before dem leave.


One of di husband of one of di woman wey dem kidnap say di kidnappers bin reach dem to pay 10 million naira.


But di truth be say di police no rescue di release of di either di orphans dem wey no get anybody.


Most local communities for Abuja don dey face kidnap mata and most times, sake of lack of effective response from di police, di villagers dey gada moni by demselves to pay ransom.



wakacometv.blogspot.com


send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria