Posts

Showing posts from January 7, 2021

TANKER FALL KON CATCH FIRE

Image
Tori As We Dey Waka Come: Today wey be Thursday 7th of January 2021, this afternoon na him di PETROLEUM  TANKER EXPLODE catch fire, as e somasult. The gbege make plenty pipo wey dey the area run go hide dem head, for safety. This particular waka happen for Apapa/Oshodi express way inside Lagos State. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica @talkamafrica

Who start Charlie Charlie challenge?

Image
Tori As We Dey Waka Come: Na waiting be Charlie Charlie challenge? Many pipo don yan say this challenge na evil spirit dey run the parrow, dem talk say na Demonic Angel be Charlie Charlie, say na evil spirit wey dey move pencil, say this na the way evil spirits dem dey use dey answer any question wey we human dey ask dem. Plenty pipo don run mad on top this waka, dem say this game dey answer question when dem call him name, Charlie three time. The game involve two pencils on top each oda, You go come put am on top of paper, wey dem write Yes or No.  The person way wan ask question go start to dey talk, after him don call charlie name three time, the pencil go move to answer the person question. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Virginity vs Good character

Image
Talk-Am As E Dey Hot: My pipo, Between Virginity & Good Character, na which one be the major pride of a woman ?? Make we Remove Sentiment inside, talk am as e dey hot?!! send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica

NIMC, don waka start strike across di kontri.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Plenty pipo no go fit register dem phone number with NIMC, on top this new strike matter. Officials of the National Identity Management Communication (NIMC) don decide to go on nationwide strike across we konri, beginning from Today, Thursday, January 7, 2021. The NIMC staff wey protest today, complain say dem deny dem allowance and plenty jolificate money during this COVID-19 pandemic. Dem yan talk say, dem dey work under pressure with no allowance from the federal government send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Elevator crash kill one person, inside Ibadan.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Elevator don crash kill one person, injure three pipo, this bad gbege happen for inside Cocoa House, for Ibadan.   send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Lagos State Deputy-govnor brother, don die.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dr Obafemi Haroun Hamzat, way be we Lagos State Deputy-governor brother, don die on top Covid-19 matter. Dr Hamzat die on Tuesday morning, according to di Lagos chapter of Nigeria medical association NMA.   send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome