Election Wahala for Inside Uganda.

Tori As We Dey Waka Come:

No be today Uganda President dey use him kontri security officers dey threaten, him rival. Him don use dem to arrest Bobi Wine, plenty times, just to tell am say, na him still be di presido and him no go allow Bobi Wine enter power as President.

As the matter dey go, him security officer dey arrest any news reporter wey dey chook mouth inside di matter.

Bobi wine wey be di leading opposition party don waka go report all di wahala wey di President and him security officials dey do for di kontri, give International Criminal Court. 
The leading opposition presidential candidate, Bobi Wine, yan as di matter be to International Criminal Court say make dem investigate human right violations.
On top this yan him talk as dem carry am inside motor, and so many things wey him eye don see since di election start.

As the matter dey hot, this week on Thursday na him Uganda police carry Bobi Wine, drag am comort inside him motor with him supporters. On top say next week na Uganda general election.

Mr. Wine, wey be popular musician-turned-
Lawmaker, na Di leading contender among 10 candidates wey dey try to win the position for presido for Uganda, since Mr. Museveni, wey be dem presido, wey don dey for office since 1986 as Uganda President.

Mr. Wine yan wetin di present Government and him security officials dem dey do, him talk say dem don kill and bit plenty of him supporters, since 2018.


send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.