Boko Haram kill 13 pipo inside one village for Cameroon.

Tori As We Dey Waka Come:
Boko Haram kill 13 pipo inside one village for Cameroon.

Di Mayor of Mozogo, Boukar Medjewe, talk say, Pipo start to dey run enter bush to hide when dis pipo enter dem village with wahala, 8 pipo die on top dis matter.

Dis na the latest tori about Dis jihadist group, way done dey happen for north since 2014. Dis week 3 vigilante die for di hand of dis group.

2 Cameroon soja get injury and 14 house burn for inside dis attack wey happen last week inside one village.
The matter wey reach us be say, so far, 2,500 Cameroonians don die for the hand of dis Boko Haram pipo since 2014 to 2017. National Ministry of Defence na him yan Di matter.

Di UN Refugee Agency pipo don gader up to 26 million pipo for lake chad kontri wey wahala of Boko Haram affect, since di time wey dem start this bad waka for 2009, inside northeast for we kontri, Nigeria and outside kontri wey dis matter affect.



www.wakacometv.blogspot.com
send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo