Posts

Showing posts from February 9, 2021

Lekki Toll Gate: Nigerian Youths Say, No Justice No Reopening

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Tori be say since di October 2020 Lekki shooting wahala, dem don stop to dey collect money, sake of di katakata wey bin happen. On Monday 8 February 2020 for Lagos state, officials of Lekki Concession Company for Lagos show face for di toll gate area. Di reopening of Lekki toll gate for Lagos State don make make many Nigeria youths to hala afta di state judicial panel wey dey investigate di shooting incident wey happenn dia give di company wey dey manage di place green light to take control. Plenty pipo dey para, dey vex well-well for dis waka wey di Judicial panel take, onto say dem neva reveal information on dia findings on di Lekki toll gate incident wey happen last year. During Di end sars shooting for Nigeria last year, October 2020, against police brutality for Lekki toll gate wey be di commercial road for Lagos, don lead to Nigeria condemnation across di world. As di matter dey sup so, Hope bin dey say di judicial inquiry set up to...

Sex Wahala: With Dis Drink, No Wahala For Married Pipu.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Tiger nut drink fit wake up your sex drive - Nutritionist Sex drive wahala na one thing wey dey bring plenty palava between man and woman. People wey sabi say e dey common dis days among young people pass as e no dey like before wen people think say na only old people wey dey suffer am, sake of say dia body don weak. Di mata dey very serious as many people wey get dis problem dey die in silence because say dem dey shame to talk am for outside. But e get one drink wey dey common wey dey help people wey get dis kain problem. Di ingredients sef no dey cost plenty money and person fit make am for house. Tiger nut. Hausa dey call am 'Aya', Yoruba dey call am 'Ofio' and Igbo dey call am 'Aki Hausa', and another name for am na Hausa groundnut. OGA KD, Chief Executive Producer (CEO) of Reis Dipo Film & WakacomeTv, for one event talk say Tiger nut drink go help man pikin wey done mary do well for bed, him talk...