Posts

Showing posts from February 20, 2021

School Girl Wey Carry Gun Enter School To Kill Teacher, Don Confess

Image
Tori As We Dey WakaCome: The secondary school girl for Ikot Ewa community, for Cross River State don come out to confess say, she na cultist for one girls confraternity, for CRS, wey dem call themselves "Sky Queen Confraternity." The girl wey dem identify as Promise Idorenyin, na 17 years old, dem   arrest her last week for one Community Secondary School for Ikot Ewa inside Akpabuyo local government area of Cross River State, after she bin try to shot one of her subject teacher with one local made pistol, wey she bin later confess say na one of her married man friend wey dey totori her body, give her. Dem still dey interrogate the girl for further inquiry of the supposed confraternity wey she mention during her confession, to know which other students and teachers wey dey at risk for that same school wey she dey attend. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakac...

Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher

Image
Tori As We Dey Waka Come: Government Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher wey tell her to barb her hair. Dis Government Secondary School girl carry one local made gun enter School for Akpabuyo, Ikot Ewa Cross River State to shoot her teacher because im tell her to cut hair hair. Dis matter happen for Community Secondary School Ikot Ewa for Akpabuyo, Cross River State, last week Thursday. E happen say, as di young girl resume school, her class teacher tell am say make she go barb her hair wey she carry come school. Dis na becos, so school for Cross River, students no dey carry grown hair come school as dem get dat kind rule, she gast go back house. Di next day she waka come school wit local gun. Di School Principal raise alarm. Pipo around come hold her and teachers, students all come out to see wetin dey sup for school. One person wey see as di matter happen yan say  im go visit im friend wey dey stay close to school wen dem h...

Commander Hisbah Arrested: Dem Don Catch Islamic Police Oga for Hotel with Woman.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di officer wey dey in charge of arresting prostitutes and beggars for Kano, Hisbah Sani Uba Rimo dey inside serious gbege after police arrest am on Monday for hotel. Police dem bin get report from one man say di Hisbah OC dey invite im wife to one hotel for Sabon Gari area of Kano city were him and di woman dey meet. Just After di arrest, Hisbah suspend officer Sani from work pending investigations dis na after di oga kpata kpata commander general Sheik Harun Ibn Sina form five man committee to investigate wetin happen. Kano Police Command confam say di husband of di woman don come forward to gree say di Hisbah OC na actually im in-law and dey try settle issues between dem. According to tok tok pesin DSP Abdullahi Haruna di whole thing don dey resolved and di Hisbah oga no get case to answer. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie....