Posts

Showing posts from April 6, 2021

Academic Staff Union Of Polytechnics(ASUP): waka with Strike on Today.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Academic Staff Union of Polytechnics (ASUP) don waka come with update say dem dey Declare Immediate Strike Over New Salary Scheme for we kontri Nigeria. Di National President of ASUP, Anderson Ezeibe para say union’s strike must commence till dem meet all demands by the Federal Government. According to di union, di matter on Tuesday 6th of April 2021. ASUP leaders don confirm di strike matter  after him waka do meeting with Federal Government officials for Abuja. Asides dis strike matter, dem dey yan say make dem put money ontop di new salary scheme, the union dey yan say make dem pay dem di salaries and promotion allowances wey dem never pay lecturers.  National President of ASUP, Anderson Ezeibe wey dey insist say strike go go on, him say dem don dialogue with the Federal Government to resolve the issues wey dem raise.  wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gm...

Nigeria President Waka Come UK for Medical Treatment.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian pipo wey dey obodo oyinbo land for UK, don waka protest against president Buhari medical trip. Him bin comot Nigeria on Tuesday 30th March, 2021 for two weeks medical checkup. Di protest waka come ontop di residents doctor's strike matter, wey dey sup for Nigeria. Dis waka wey start on 1 April, 2021-  days afta Buhari land London for im medical check-up. Dem dey yan ontop di protest say, government dey owe doctors dem salary and also refuse to pay oda allowances dem suppose get during di coronavirus pandemic. To express dia displeasure for di medical trip, Omokri lead a group of protesters to protest for di gate of di Nigeria Abuja House, dem parra well well, say make presido waka go back to Nigeria go do him medical checkup.  Dem dey vex say why di president go comot Nigeria wen Nigerian doctors dey on strike. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp ...