Posts

Showing posts from March 15, 2021

Fatgbems Filling Station Sell Water to Customers in Disguise as Petrol Price Don Enter N212.

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Di matter happen on Sunday 14th of March for Abeokuta, Southwest Nigeria within di same period wen fuel price hike bin happen for all filling stations across di kontri. Di matter don cast for social media, inside one video wey customer notice say na water dem sell give am, plenty pipo don come back to confirm di matter wey make dem car engine get fault. Dis video wey dey trend for social media show where some customers dey lament and accuse di filling station of cheating - di video also show where some car owners dey check dia vehicles to find how to comot di water from dia engine. Di management of Fatgbems filling station for di statement wey dem bring out tok say wetin make dia nozzle pump water instead of fuel na because of "water overflow into one of di station storage tanks." E talk inside statement say, "Fatgbems go like tok am again say di unfortunate incident dey against as we dey take do business as w...

Davido Celebrate with Wizkid and Burnaboy for Di Grammy Award Wey Dem Win.

Image
Tori As We Dey Waka Come: David Adeleke a.k.a Davido don waka come on top him twitter page @davido to congratulate him brothers wey win Grammy award, wey shele yesterday 14th of March 2021. Davido wey dey America right now dey enjoy life talk on top him twitter page say him dey happy for burnaboy and wizkid, e yan say dis award na for All Nigerians and we culture. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome