Posts

Showing posts from January 14, 2021

NIN blame network for delay of registration

Image
Tori As We Dey Waka Come: As we carry waka enter NIN office, we yan with one of Di staff, him yan say, no be small job everyday, plenty pipo go come for registration and after some time, network go bad, na him make dem to dey shut down, dis matter dey make pipo vess, and di Queue dey long well well. We yan with one of di pipo on top dis long Queue, her name na madam chioma. Madam chioma yan on top how she take do her Registration waka, inside NIN office for Abuja. Madam chioma: Dem say make I come back next month after them don give me number inside paper say na him dem go use attend to me, the crowd dey plenty, as early as 8am, pipo don full plenty for long Queue every day, but after 3pm dem go yan say dem wan shut down, say di network no dey work well well again, na till di next dey be that, dis na wetin my eye see, on top dis NIN registration, no be small matter. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We ...

Uganda: Election in Chaos

Image
Tori As We Dey Waka Come: Today Na Election day For Uganda, but plenty pipo dey fear to come outside come vote. The matter dey hot as Uganda government don shot down internet for Uganda. No be small waka as Bobi wine wife, dey show inside wan video wey go viral, as Di Government security officer dey bit am. Uganda youths dey para, na him make dem wonder if International criminal Court  (ICC) dey work.  Today wey be 14th of January 2021, Election don start inside Uganda, Di Government don shut down internet and wahala dey happen every where. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie.

Bone Straight hair and why e dey very expensive.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside Dis video on top we youtube channel wakacomeTv, you go See as di matter dey sup ontop dis Bone Straight Hair, and why e dey very expensive to buy. Many women for we kontri, don buy this hair to fit follow do Yanga and shakara, dis no be small wahala for lady wey no get money to buy this hair. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome https://youtu.be/wzAyOT1jKuY