Posts

Showing posts from November 9, 2022

Nigeria president waka go meet with King Charles III

Image
Tori As We Dey WakaCome: Nigeria president waka go meet with King Charles III for di first time since e climb di throne. Na on Wednesday President Muhammadu Buhari  meet di new King of England, King Charles for Buckingham Palace, United Kingdom. We presided dey for London on a two-week trip for “im routine medical check up.” Presidential toktok pesin, Femi Adesina say presido go return back to Nigerian on di second week of dis November. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page. Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top twitter @wakacometv You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv  If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com As we dey waka, no be lie.

Wife of di man wey burn I'm stepchildren yan di tori as e take happen.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Wife Of Di Man Wey Burn I'm Five Stepchildren - My Husband Try To Run Away With Di Twin We Get Togeda Madam Esther Ojo narrate how e happun tok say her husband bin come home dey vex and later go buy petrol keep for house, tell am say e dey carry am go work di next day. mama of di five children wey dia stepfather allegedly set on fire for Ondo state , Esther Ojo say her husband bin don first tok say im no want make di children stay wit am. Authorities for Ondo state southwest of Nigeria confam say dem arrest di 54-year-old man afta im allegedly set ablaze im five step children on Friday night. Three of di children die sake of di fire while two dey collect treatment for one goment owned medical facility for di area. Police tok tok person for di state Odunlami Funmilayo, tell Tori pipu say di pikin wey die bin burn beyond recognition. Madam Esther Ojo say dem bin dey sleep for night around 3am wen one of her pikin wey dey about 1...

Nigeria Court tell Oga of EFCC make him go relaxed for prison

Image
Tori As We Dey WakaCom Di EFCC oga bin tok as in dey answer questions from tori pipo afta im budget defence session with lawmakers for di House of Representatives yesterday 8th of November 2022. Im say im organisation go make sure say di law, di provisions take im full course. Oga Bawa still tell tori pipo say dem don recover plenti proceeds from crime dis year. "We don get quite a lot of proceeds from crime and di provisions of Coker tok say make each relevant agency open confiscated and forfeiture accounts, we don open am and we dey remit evritin wey belong to Federal Goment into dat account. We dey also pay victims of crime from dat recovery account". EFCC oga also add say di Commisssion need more more for di new EFCC Academy wey go help dem dey ahead of di criminals through training nad re-training. "We dey build a brand new EFCC Academy and we need funding for am, last year dem allocat Three billion while dis year nothing nothing, na why we d...