Wife of di man wey burn I'm stepchildren yan di tori as e take happen.
Tori As We Dey WakaCome:
Wife Of Di Man Wey Burn I'm Five Stepchildren - My Husband Try To Run Away With Di Twin We Get Togeda
Madam Esther Ojo narrate how e happun tok say her husband bin come home dey vex and later go buy petrol keep for house, tell am say e dey carry am go work di next day.
mama of di five children wey dia stepfather allegedly set on fire for Ondo state , Esther Ojo say her husband bin don first tok say im no want make di children stay wit am.
Authorities for Ondo state southwest of Nigeria confam say dem arrest di 54-year-old man afta im allegedly set ablaze im five step children on Friday night.
Three of di children die sake of di fire while two dey collect treatment for one goment owned medical facility for di area.
Police tok tok person for di state Odunlami Funmilayo, tell Tori pipu say di pikin wey die bin burn beyond recognition.
Madam Esther Ojo say dem bin dey sleep for night around 3am wen one of her pikin wey dey about 17 years shout from dia room say ‘mummy fire dey burn’.
“I bin no fit sleep dat night because wen my husband come house, I just notice say e dey vex.
“I greet am e no ansa me, but I see say for night im waka comot from house go buy petrol.
“E go hide di petrol tok say im wan use am go work di next day becos im be operator
“For night I notice say im no gree sleep, I ask am wetin happun but e tok say nothing. Me sef dey fear because I dey wonder wetin fit dey worry am.
Dis na di tori wey we carry waka come.
As we dey waka, no be lie.
Remember to follow us on top we social media page.
Facebook @wakacometv
Instagram @wakacometv
Follow us on top
twitter @wakacometv
You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv
If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or
send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com
As we dey waka, no be lie.
Comments
Post a Comment