Nigeria Court tell Oga of EFCC make him go relaxed for prison

Tori As We Dey WakaCom



Di EFCC oga bin tok as in dey answer questions from tori pipo afta im budget defence session with lawmakers for di House of Representatives yesterday 8th of November 2022.

Im say im organisation go make sure say di law, di provisions take im full course.

Oga Bawa still tell tori pipo say dem don recover plenti proceeds from crime dis year.

"We don get quite a lot of proceeds from crime and di provisions of Coker tok say make each relevant agency open confiscated and forfeiture accounts, we don open am and we dey remit evritin wey belong to Federal Goment into dat account.

We dey also pay victims of crime from dat recovery account".

EFCC oga also add say di Commisssion need more more for di new EFCC Academy wey go help dem dey ahead of di criminals through training nad re-training.

"We dey build a brand new EFCC Academy and we need funding for am, last year dem allocat Three billion while dis year nothing nothing, na why we dey beg members say we need dis new EFCC Academy sake of say we need to learn, as fighters of crime we need to dey ahead of dis criminals, di only way to do am na to rain and re-train, I believe say di National assembly go hear our request" oga Bawa tok

Abuja convict di oga of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Abdulrasheed Bawa for contempt, plenti reactions full ground.

Di court direct make dem lock Oga Bawa for di Kuje correctional facility, for di Nigerian capital, Abuja. Pending wen dem obey one court order wey say make di commission return one range rover and di sum of of N40 million naira.

EFCC say dem don return di vehicle but di moni still dey dia hand.


Justice Chizoba Oji wey give di judgement also direct di Inspector General of Police, Usman Baba to make sure say im execute di order of di court sharp sharp.

EFCC oga Abdulrasheed Bawa say dem go allow di law to take im natural course on di mata.

42-year-old Bawa tell tori pipo Channels TV say dem don appeal di order.

Later for statement EFCC tok tok pesin say dem receive di judgement as surprise as dem get good relationship wit di judiciary and dey always appear for court.

EFCC say Oga Bawa no be dia chairman wen court give di initial order for 2018 (to return di items), but as im get knowledge of di ruling e begin act on am.

For statement, dem reveal say dem don already release di car to di applicant since June 2022

Oga of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Abdulrasheed Bawa don tok say im agency (EFCC) don appeal di judgement wey di Federal Capital Territory (FCT) High Court give earlier, wey convict am for contempt of court.


Di judgement also say make Abdulrasheed Bawa go relax for Kuje prison sake of say im agency fail to comply with one court order wey happun before.


Dis na di tori wey we carry waka come.
As we dey waka, no be lie.
Remember to follow us on top we social media page.
Facebook @wakacometv
Instagram @wakacometv
Follow us on top
twitter @wakacometv
You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv 
If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or
send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com
As we dey waka, no be lie.

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria