Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Tori As We Dey Waka Come:
School Resumption Stop, As House of Representative Dey ask for 3months before schools go fit open back again

House Of Representative, don waka against federal Government wey talk say make school dem open Today wey be Monday 18th of January  2021.

Di House Of Representative, Don fall federal Government hand on top Dis school opening  matter, Dem say coronavirus don come up, Dem talk Dis inside book say, coronavirus Dey very dangerous and E Dey kill pipo, Dem no go fit agree make school open inside dis coronavirus.
Na on Saturday 16th, 2021, Dem write on top paper give Prof. Julius Ihonvbere, wey be Di chairman of House Committee, on top Basic Education and service, inside Dis Paper dem yan say, make dem check how coronavirus dey kill pipo, dis na di second wave, e be like say dem dey play on top dis coronavirus, because school no suppose open now, we school never ready to open at all, coronavirus no sabi small pikin, E dey kill plenty pipo everyday.
Di House of representative check dis matter well well, Dem say na true, coronavirus dey kill pipo anyhow, on top say di matter don come up well well, E no go good make school open now, and dem also come yan say dem go need 3months to fit torchlight di matter well well, make school never open now, na after dis 3months dem go dey ready to fit open school, dis na for di safety of everybody.

The House Rep talk say na inside dis 3month dem go fit provide facemask and sanitization for many Government schools wey never get for some States.

www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome




Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Omah-Lay get Artist Twin Broda?

Government Science College, Kagara, kidnap update: Buhari deploy soldiers, Governor close down school, Senate demand State of emergency.

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.