Posts

Showing posts from January 16, 2021

4 Tips way go help you on top your NIN/Simcard/Bank acount

Image
Tori As We Dey Waka Come: 4 matter wey fit make you enter wahala.  Number 1: no use your face and information to go helep any body, to register sim card, or else the person go use the sim do magomago, na you go enter wahala. Number:2 As the matter be now way your account details don dey together with your phone, no let any one use am make call again for your back. If the person use your phone call, dem fit do magomago. Number:3 No allow any body use your phone browse, make dem no go login to any social media account, if dem log in, dem go fit use am get into your bank account. Number:4 From now make sure say you no dey share your phone with any body, because e don be like your ATM and BVN now. Abeg share this tori give everybody. Dis na security information wey go helep you on top your NIMC wey connect to your bank account and your sim card.                     ...