Posts

Showing posts from January 19, 2021

Di Man wey deny baby mama, need baby son back.

Image
WakaCome Tv Abeg hide my identity, 14yrs ago, e get one geh wey dey our area and every guy for the area know say she be losed geh and she just dey open legs for guys anyhow. During that time me sef come say make I go catch my own cruise, na so she come tell me say she don get belle from the kind play wey we play. But I deny am flat since no be only me dey sleep with her. After she born, the pikin resemble me well well but i still deny the baby. Six years ago I come marry, my wife don get two children for me and the two of dem na girls. The second belle wey my wife bin born na by the grace of God she survive bcos she get serious complication and Doctor say after that birth, she no go fit born again. Now as the mata be, na girls I get but I no get baby boy, I come go meet that lady wey bin born for me bcos na boy she born. Wen I reach dia house, she don marry and her family don officially adopt the baby as dia own. Dem pursue me say make I no ever come the house again and say I no get an...

Water Don carry pipo go for Burundi

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside, Burundi heavy rains don carry waka plenty pipo property, dis water don cover thousands of pipo house. Di Gatumba, Mutimbuzi region located 5km from Bujumbura province don suffer from heavy floods, since Monday January 11, dis one happened after di Rusizi River wey be di tributary lake for Tanganhika, vess comfort come out side on cover this community with pipo house, di pipo don dey cry for movement make dem helep dem build back dier property, eye water don carry waka. One of di pipo wey dey cry for help, yan say dem dey beg di movement, make dem help dem block dis River wey don carry water cover dier community. Di National Platform for Risk Prevention and Disaster Management talk say make all di pipo comfort pack comfort go another place, till di time wey dem go fit solve di matter. Dem yan say dis na di second time wey dis water go waka cover pipo house and road, say dis matter don happen before for may 2020, wey E carry plenty pipo propert...