Di Man wey deny baby mama, need baby son back.

WakaCome Tv Abeg hide my identity, 14yrs ago, e get one geh wey dey our area and every guy for the area know say she be losed geh and she just dey open legs for guys anyhow. During that time me sef come say make I go catch my own cruise, na so she come tell me say she don get belle from the kind play wey we play. But I deny am flat since no be only me dey sleep with her. After she born, the pikin resemble me well well but i still deny the baby. Six years ago I come marry, my wife don get two children for me and the two of dem na girls. The second belle wey my wife bin born na by the grace of God she survive bcos she get serious complication and Doctor say after that birth, she no go fit born again. Now as the mata be, na girls I get but I no get baby boy, I come go meet that lady wey bin born for me bcos na boy she born. Wen I reach dia house, she don marry and her family don officially adopt the baby as dia own. Dem pursue me say make I no ever come the house again and say I no get any son for dia house that if I try come back again, dem go arrest me. 

World pipo, abeg e dey possible say I fit get my son back, dis boy resemble me well well for everything. I don carry elders from my family go their house and dem send us back. Abeg make una advise me on wetin I fit do to get dis boy back if possible.

Man beg for baby boy

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.