Yemi Alade and Patoranking: Something Romantic Dey Go On.

Entertainment Waka:


Yesterday, 25th of January, our own award winning, Super talented Nigerian artists post dia pictures for dia Instagram page, of the both of dem for di same traditional cloth for one traditional wedding wey happen last weekend.


Tori wey reach us be say, this two talented lovebirds don dey cook something lovecious underground since. Na dia the same the same cloths and dia hands tied together, for the event na him make the before before rumour true.


Dis two superstar artists, don dey call dem selves sweet sweet names for social media page. Top celebrities sef and many people don dey use the matter congratulate dem for their social media handles.

Skyrocket Patoranking and Yemi Alade, WakaComeTv dey congratulate whona two oo. We dey wait for whona to serve us di sweet love aroma wey we dey perceive.


wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome


Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.