Plasings

Wys tans plasings vanaf Desember, 2022

Merry Christmas to una

Prent
WakaComeTv  We say Merry Christmas to everybody we dey torchlight our waka on top we Blog online, as we dey waka, no be lie. 

ABUJA, KADUNA train go open Monday, 5th of December, 2022

Prent
 Tori As We Dey WakaCome: According to di statement, di train stations go open from 6:30 for morning on Monday, 5 December, 2022 and na only two services dem go dey run for now “di first train go comot from di Rigasa train station for Kaduna state to Abuja by 8:00am in di morning. From Abuja, di first train go leave di Idu train station to Kaduna state by 9:45 for morning” E tok. Di Railway Corporation also tok say dem don get new security measures. One of di measures na for passengers to present dia National Identity Number (NIN) and valid Boarding Ticket before dem go allow dem to enta di train. Di statement tok say to buy ticket now by proxy go only dey allowed for minors and a specified number of adult passengers. You fit buy tickets online and you fit use you mobile app buy ticket too from 8' 0 clock on Sunday morning 4, December, 2022. Residents of Abuja and Kaduna for north central Nigeria fit start to travel wit train services again. Di Nigeria Railway Corporation (NRC) say

Gunmen kidnap person inside mosque for Funtua, Katsina State, northwestern Nigeria.

Prent
 Tori As We Dey WakaCome: Gunmen kidnap person inside mosque for Funtua, Katsina State, northwestern Nigeria. jaguda pipo open fire and kidnap almost twenty worshippers on Saturday night wen Muslim worshippers gada for prayers. Nigerian police tok-tok pesin for Katsina state, Gambo Isah tell yan say di Imam of di mosque and one oda worshipper wound - But dem don discharge dem from hospital afta dem collect treatment. Oga Isah tok say a combined team of police, di military and local vigilante bin immediately rescue some of di pipo dem kidnap. Im say 13 pipo still dey miss. E add say dem dey make efforts to track down di suspected kidnappers and rescue di pipo wey di gunmen kidnap. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsAp