Plasings

Wys tans plasings vanaf Januarie, 2021

PSC: Dem Don Promote plenty police officers Dem.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: IGP Mohammed Adamu We Nigerian Police Service Commission, (PSC). Don Promote plenty police officers dem. Na Nine Commissioners of Police wey go enter for Di rank of Assistant Inspectors General of Police and another nine, wey dem promote from di rank of Deputy Commissioner to Commissioners of Police. Di Commission sef approve Di promotion of three Chief Superintendents to Assistant Commissioners of Police, 1,577 Deputy Superintendents to Superintendents of Police and 2,293 Assistant Superintendents to Deputy Superintendents of Police. Dem also approve the promotion/confirmation of seven thousand, two hundred and eight three unconfirmed Assistant Superintendents (ASP11) to Assistant Superintendents of Police (ASP1), nine thousand and seventy two Inspectors to Assistant Superintendents of Police (ASP11) and one hundred and ten Inspectors promoted to Senior Inspectors. Di new Assistant Inspectors General na; Aminu Saleh Pai, former Commissioner of Police

Nigeria President, sack im service chiefs, appoint new service chief on Tuesday.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria President Muhammadu Buhari don sack im service chiefs wey him appoint for office since july 2015, on Tuesday na him President Buhari sack dem come replace dem with this new pipu dem, this na di name of Nigeria new service chief, Major-General L.E.O Irabor, go replace General Abayomi Olonisakin, Rear Admiral A.Z Gambo, go replace Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe, Air-Vice Marshal I.O Amao, go replace Air Marshal Sadique Abubakar, Major-General I. Attahiru, go replace Lieutenant General Tukur Yusuf Buratai. Dis Na Di Picture of Di new service chiefs wey  President Muhammadu Buhari appoint on Tuesday. Dis Na Picture Of President Buhari and the old Service Chiefs wey him sack on Tuesday, for inside one meeting for Presidential Villa Abuja. Na on di 13th July, 2015 (four years and six months ago) na im Buhari bin appoint all the service chiefs. Sake of tension and security concerns wey dey the west African kontri for some ti

MAMA's AWARD: Na Who Be Di Best African Artist?

Prent
Entertainment Waka: MAMA AWARD 2021 Di name of di Nigerian artist wey go carry Join body for Dis Honour Award, na Davido, Wizkid, Burna Boy, Simi, Dj neptune and plenty others. Dem don nominate Burna Boy, 2 times for Di best collabo, for Dis song, "Monster You Made", wey him waka do with Chris Martin, and di song wey him do with South African Artist, Master KG, remix of Jerusalem jam, Na dis songs wey make dem nominate am for best collaboration artist. Dem also nominate Simi and Adekunle Gold enter nomination category for Best Alternative.  Di pipu wey follow dem enter dis waka na some Ghanaian superstars, Amaarae, alongside South Africa’s Ama Faku and Kenya’s Matata. Wizkid (Smile, ft H.E.R.), Yemi Alade (Shekere ft Angelique Kidjo) and Burna Boy (Monsters You Made ft Chris Martin), dis na all di pipu wey waka enter nomination for di Best Collaboration award. Afro-Street/Pop artiste, Naira Marley, enter waka for Best Fan ba

Yemi Alade and Patoranking: Something Romantic Dey Go On.

Prent
Entertainment Waka: Yesterday, 25th of January, our own award winning, Super talented Nigerian artists post dia pictures for dia Instagram page, of the both of dem for di same traditional cloth for one traditional wedding wey happen last weekend. Tori wey reach us be say, this two talented lovebirds don dey cook something lovecious underground since. Na dia the same the same cloths and dia hands tied together, for the event na him make the before before rumour true. Dis two superstar artists, don dey call dem selves sweet sweet names for social media page. Top celebrities sef and many people don dey use the matter congratulate dem for their social media handles. Skyrocket Patoranking and Yemi Alade, WakaComeTv dey congratulate whona two oo. We dey wait for whona to serve us di sweet love aroma wey we dey perceive. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #tor

Militan enter Imo State, wey make Curfew start on monday January 25, 2021.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di Governor Imo State on Monday, January 25, 2021, yan about waiting dey sup wey make am declare curfew. Governor Hope Odidika Uzodinma, don yan give doesesidents of him State, say, time go dey dey wey pipu no go fit waka come outside at all, him do dis waka on top wating happen inside some local government areas fo Imo State, na only 9 local government dis curfew dey waka with, di name of dis 9 local government na, Orlu, Orsu, Oru East, Oru West, Ideato North, Ideato South, Njaba, Isu, Nwangele and Nkwerre local government areas of Orlu zone. Di Governor take dis action after wetin happen for Imo state with some soldiers and militants. Some pipu talk say di matter wey happen between soldiers and militants pipu, wey dey worry ontop di State, according to di pipu wey see as di matter happen, say di militant don kill and destroy things. Governor dey beg di security pipu, make dem catch dis bad pipu wey dey do dis killing, to fit put dem for jail, dis

OPC warn President Buhari and Fulani herdsmen

Prent
Tori as we dey waka come: OPC warn President Buhari, say dem support Sunday Igboho. Dis Sunday na him Di Oodua pipu warn president Buhari say, dem no dey joke ontop dis matter at all, as him don make am clear say him dey support dis herdsmen wey dey enter villages dey kill pipu, dem say dis na warning, make dis herdsmen waka comot from yoruba kingdom. Mr Wasiu Afolabi, Deputy President to the late OPC Founder, Dr Fredrick Fasehun, yan say, no Southerner go waka enter North go dey kill pipu, but why dis northern pipu dey enter pipu zone dey kill kill, and Nigeria President no dey yan ontop dis bad waka. OPC talk inside Sunday Igboho matter, say na good thing Sunday waka do, to protect yoruba kingdom, say dem support Sunday, and make dem free Sunday from any arrest. Odua pipu don halla give President Buhari say make him stop to dey take side on top dis killing wey herdsmen dey kill kill innocent pipu for insde dia land, Oodua don come outside with Amotekun to fit stop dis bad pipu wey de

Sunday Igboho: Fulani Herdsmen Dey Plan War

Prent
Tori as we dey waka come: Yoruba's don Fem Governor of Oyo state, say him no dey support the safety and security of Yoruba land but him dey play on top dis matter, for him own political ait. Sunday Igboho, don dey rain for news, as him help to secure and stop bad pipo wey dey kill innocent pipo inside Yoruba land. Him bin give fulani pipo wey dey kill pipo inside bush, seven-days make dem carry dia self comot for Yoruba land, as dem no sabi good thing to do, dan to dey kill and kidnap pipo inside forests. Oyo State Governor, don yan on top dis matter say, no be Fulani pipo dey kill pipo. Mr. Igboho Sunday Na October 10th 1972, dem born am, inside Igboho town, for Oke-Ogun, Oyo State. Na youth activist for Yoruba land him bi, but some pipo dey yan about am say Na politician dem sabi say him bi.   The whole of YORUBA Kingdom dey vex with President Buhari and the IGP wey say make dem arrest Sunday Igboho, dem talk say Sunday Igboho dey do better waka to help secure Yoruba land f

Gunmen attack Dutsin Gari Village and others

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di villages gunmen attack na Dutsin Gari, Asha-lafiya, Rayau, Munkuru, Mahunta and Talli. Maigari yan say di residents of di affected villages want make government help dem. Matawalle yan to the community pipo say, make dem no worry say him and him pipo go helep dem. Him say him dey worry ontop di matter wey happen, say him no happy at all, and him dey feel serious pain ontop the matter. “I assure you that I will do everything within my powers to make sure that you go back to your respective villages." Him yan Him talk as him go make sure say dem dey okay and every body dey safe for dia villages. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

IGP Adamu don confirm di arrest of Sunday Igboho.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: IGP Adamu don confirm di arrest of Sunday Igboho. Di Inspector General of Police, Mohammed Adamu don order di arrest of Sunday Igboho over ultimatum to Fulani herdsmen Inspector General of the Nigeria Police, confirm say him arrest Igboho come abuja, to face prosecution. According to him, Igboho dey part of the people wey say make fulani herdsmen pipo comot for di land. Igboho yan last week Friday say him give fulani pipo seven days, make dem leave Oyo state because dem dey kill pipo any how for forests. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Court sentence 52years old man, wey steal, Infinix Phone.

Prent
Tori As We Dey Waka Come On Friday inside Ogun state, one Court waka sentence, one man wey go steal infinix phone, dis man name na Usman Abfullahi, him be 52 years old. Di Magistrates’ Court talk say make dis man go spend three months with Community Service inside prison. Di name of di person wey sentence di man go prison na Magistrate Dehinde Dipeolu, but dem say di man dey beg dem say na devil hand work be dis, him say make dem pity am, as him be old man, him say make dem forgive am say him no go do am again. Di police man wey catch am, talk inside the matter, him tell di court say na on di 19th of January, around 2pm, for Panseke area inside Abeokuta, dis man run enter Ibrahim Ogudipe shop, wey bi computer operator, him tell am say him wan buy Infinix hot9, for him hand, e no finish for dia, him enter another shop of Oluwasegun Olorunmade wey be tailor,  E lie for dis tailor aay him need to arrange cloth for am, na so him take carry phone waka dey go. www.wakacometv.blogspo

COVID19: British Prime Minister Boris Johnson Don Para Give U.K OnTop Dis New CoronaVirus.

Prent
  Tori As We Dey Waka Come: British Prime Minister Boris Johnson don halla on Friday, to government pipo inside U.K, say dis new coronavirus go dey kill pass before own, dis na di matter wey him see on top dis second wave of coronavirus, make dem take action to dis matter, dis no be small matter at all wey dem go dey use play, as di coronavirus never get medicine wey fit remove am for person body. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Luton Shelton Former Jamaican Footballer don die

Prent
Sport-Waka: Luton Shelton Former Jamaican Footballer don die at 35.  Dem bin diagnose am with amyotrophic, na on top dis matter him die, him bin get moto neurons disease wey make am retire to dey play ball in 2018. Plenty pipo don cry say dis former striker die, him padi dem wey play ball with am self dey cry on top dis matter, dem no happy at all. Him don play ball for plenty club and him score 35 goals for him country, Jamaica. Him play 25 times for blades, after him play finish for Helsingborg inside sweden, him score four times inside 21 games www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #sportwaka

Legit COVID-19 medicine don finally Waka Come outside for Isreal.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Israel na di oga for all di world now, as dem don carry waka come with di medicine wey dey remove coronavirus for person body. On top dis same matter, United States of America don do plenty waka to helep for COVID19, still e no work, but Israel don get medicine wey go remove coronavirus kpatakpata. Since January 19, 2021, 25.6% of di pipo wey dey Israel don collect dis medicine, wey dey remove coronavirus for body di number of pipo wey don collect am now na 550,000 pipo. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Nigeria President Don Warn FIRS, Make Dem No Dey Look Uche Face To Collect Money.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: President Muhammadu Buhari yesterday yan say, make di Federal Inland Revenue Service (FIRS) and other agencies, no dey play with money matter, say make dem dey collect tax money from all di foreign companies wey dey work inside Nigeria. Him talk dis matter inside Abuja, State House, say make dem dey waka sharp sharp on top tax matter. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Google and Facebook go waka comot for Australia.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Google and Facebook go waka comot for Australia, if di government put am for law, say make dem dey pay pipo money. Google don talk say, dem go comot for Australia and dem go block every body wey dey Australia for Google, if di government confirm say dem go dey pay pipo money for dia business ontop google. So Australia government go soon put am for law say, make google and facebook dey pay pipo money for wetin pipo get to dey do ontop dia site. Google yan say dem go block news reporter wey dey use dia google site to dey torchlight matter. country no go fit dey browse on top google again to search for news from Australia, and Australia no go get news online again if dem block Australia. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Covid-19 Second Wave: Olympic Agency Dey Fight Japanese Government over Tokyo 2020.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di Deputy Chief Cabinet Secretary don deny sey dem cancel di Olympic Game, dem say na coronavirus wey dey worry dem, make dem talk like dat, dem say dem dey arrange for di year 2032 Olympic game for Tokyo, by that time coronavirus no go dey, Japanese Government don cancel Olympic Games wey suppose start on Di 23 rd Of July. Anoda Tori wey reach us be say, Di Japanese government talk say, pipo dey kpai ontop Dis coronavirus every day, so dem no go fit allow dis game waka come, dem go stop am till, 2032. Organisers dey parra dey say di game must happen inside dis coronavirus, dem say di Tokyo Olympic Game go open dis year, make di government try understand. Osaka Mayor Ichiro Matsui don talk say, make dem look as dis second wave of coronavirus dey kill pipo anyhow, say e go good if dem change di date till 2024, because of dis coronavirus.   www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We D

Ondo State give herdsmen 7days to waka comot for di state.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Inside Akure yesterday, plenty pipo waka come outside to support di matter wey governor talk. Governor of Ondo state, yesterday talk sey E give headsmen 7days, make dem waka comot from Ondo State, and forests. Governor Oluwarotimi Akeredolu don order Say make all dis herdsmen dem comot from bush inside forest for Ondo State, dem say dem no wan see dem at all, him don give dem 7days make dem waka. Di pipo of Ondo State, happy with dis good decision wey Governor yan, Di Chairman of the National Union of Road Transport Workers, Comrade Jacob Adejo sef talk about how dis herdsmen dey kill pipo, him say road no dey safe again because of dis herdsmen dem. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

US President 1st day inside office cancel Nigeria and some kontri from Ban

Prent
Tori As We Dey Waka Come: On Wednesday wey be 20th of January 2021 Donald J. Trump colourr for White House. Joe Biden don waka enter White House, As di new President of di United States of America. Today wey bi 21th of January him yan on top paper, one of di waka wey him go like change, as di new president. Today wey go bi him first day inside office, Joe Biden don cancel all di ban wey former US President give, as di matter dey sup now, all di kontri wey Trump no allow to enter US go fit enter now. Di name of di kontri wey go fit travel go US now with out wahala na, Nigeria, Eritrea, Yemen, Sudan and some kontri. Dis wan go dey for history say black woman enter power as vice president of di United States of America yesterday, when dem put dem for office. Di new president wey enter office on Wednesday, yesterday wey bi 20th of January 2021, as di President of di United States of America, him name na, Joe Biden and him vice president na black woman, her name na Kamala Harris, Dis

Vice Principal Rape, 12 years old girl in kastina.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Vice principal arrested for impregnating 12-year-old student in Katsina. Police don arrest One Vice Principal of one secondary school for impregnating one of the students for the school. Dis matter happen for Rimi Local Government Area of Katsina State, the teacher name na Ibrahim Tukur. E get one secondary school for Rimi Local Government Area inside Katsina State, na him one Vice principal Ibrahim Tukur, give small pikin wey be student of di school, belle. Police don arrest this Ibrahim. Presently, the girl wey him give belle na 12 years old pikin, and dis 12 years old girl don born di pikin. Ibrahim Tukur and him padi wey dey do dis bad thing, police don catch all of dem on Wednesday, dem dey inside Kastina Police Command headquarter www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Woman Die With Her Baby For Road Yesterday

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Dis wan happen yesterday 20th of January, Inside warri Delta State, as police dey waka with motor to catch yahoo boys, dem kon go jam one keke wey carry passenger of one woman and her small pikin, for road on top high way, dis woman and her pikin kpai instantly. Dis wey dey painful so, happen for PTI junction inside Effurun. Di police wey jam dis woman and her pikin, na from Ebrumede police station dem come from. Di pipo wey use eye see the matter no happy at all as di woman and her pikin die,  dem burn police motor wey jam dis woman inside keke, dem even block road. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

FG Don Waka Come, To Help Give Pipo Time For NIN Registration.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Federal Government don give time, for we  pipo to fit waka on top we SIM card with NIN, FG talk say as di time no plenty for we pipo to fit do dis waka, dem don add time to am, di matter wey dem yan before bi say e go stop yesterday, wey be 19th of January 2021, now federal government don give everybody time till next month, on di 9th of February 2021, dis na good news for everybody wey never waka go do him registration.   Di  mobile network operators (MNOs) pipo don yan about di matter wey make Federal Government give we pipo time, dem talk set make we pipo self try waka come for registration, because na 9th of February go be di final closing time. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Di Man wey deny baby mama, need baby son back.

Prent
WakaCome Tv Abeg hide my identity, 14yrs ago, e get one geh wey dey our area and every guy for the area know say she be losed geh and she just dey open legs for guys anyhow. During that time me sef come say make I go catch my own cruise, na so she come tell me say she don get belle from the kind play wey we play. But I deny am flat since no be only me dey sleep with her. After she born, the pikin resemble me well well but i still deny the baby. Six years ago I come marry, my wife don get two children for me and the two of dem na girls. The second belle wey my wife bin born na by the grace of God she survive bcos she get serious complication and Doctor say after that birth, she no go fit born again. Now as the mata be, na girls I get but I no get baby boy, I come go meet that lady wey bin born for me bcos na boy she born. Wen I reach dia house, she don marry and her family don officially adopt the baby as dia own. Dem pursue me say make I no ever come the house again and say I no get an

Water Don carry pipo go for Burundi

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Inside, Burundi heavy rains don carry waka plenty pipo property, dis water don cover thousands of pipo house. Di Gatumba, Mutimbuzi region located 5km from Bujumbura province don suffer from heavy floods, since Monday January 11, dis one happened after di Rusizi River wey be di tributary lake for Tanganhika, vess comfort come out side on cover this community with pipo house, di pipo don dey cry for movement make dem helep dem build back dier property, eye water don carry waka. One of di pipo wey dey cry for help, yan say dem dey beg di movement, make dem help dem block dis River wey don carry water cover dier community. Di National Platform for Risk Prevention and Disaster Management talk say make all di pipo comfort pack comfort go another place, till di time wey dem go fit solve di matter. Dem yan say dis na di second time wey dis water go waka cover pipo house and road, say dis matter don happen before for may 2020, wey E carry plenty pipo propert

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: After Di announcement about Di election wey dem do for Uganda, pop star Bobi wine, waka yan press pipo about di magomago and wuruwuru wey happen on top this election. Him yan say, na lie lie result and him no go accept am, say Yoweri Museveni no be him presido. Just after him yan dis matter for him house, na him soja plenty stand in front of him house, dem no allow any body to enter again to go see Bobi Wine, and him no fit come outside to see anybody, dis one na house arrest dem give am, soja jump enter Bobi Wine house, when him wife dey try plug fruit wey dem go chop, as food don finish inside house for dem to chop, di soja no allow bobi wine wife to plug di fruit, now Bobi Wine dey cry out to pipo to helep chook mouth inside Dis matter, as food don finish inside house, and dem no allow dem to come outside. 76 years old Yoweri Tibuhaburwa Kaguta Museveni, wey don be President for Uganda since 1986, don waka put him self again as the presido of Uganda, na

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: School Resumption Stop, As House of Representative Dey ask for 3months before schools go fit open back again House Of Representative, don waka against federal Government wey talk say make school dem open Today wey be Monday 18th of January  2021. Di House Of Representative, Don fall federal Government hand on top Dis school opening  matter, Dem say coronavirus don come up, Dem talk Dis inside book say, coronavirus Dey very dangerous and E Dey kill pipo, Dem no go fit agree make school open inside dis coronavirus. Na on Saturday 16th, 2021, Dem write on top paper give Prof. Julius Ihonvbere, wey be Di chairman of House Committee, on top Basic Education and service, inside Dis Paper dem yan say, make dem check how coronavirus dey kill pipo, dis na di second wave, e be like say dem dey play on top dis coronavirus, because school no suppose open now, we school never ready to open at all, coronavirus no sabi small pikin, E dey kill plenty pipo everyday. Di House of

4 Tips way go help you on top your NIN/Simcard/Bank acount

Prent
Tori As We Dey Waka Come: 4 matter wey fit make you enter wahala.  Number 1: no use your face and information to go helep any body, to register sim card, or else the person go use the sim do magomago, na you go enter wahala. Number:2 As the matter be now way your account details don dey together with your phone, no let any one use am make call again for your back. If the person use your phone call, dem fit do magomago. Number:3 No allow any body use your phone browse, make dem no go login to any social media account, if dem log in, dem go fit use am get into your bank account. Number:4 From now make sure say you no dey share your phone with any body, because e don be like your ATM and BVN now. Abeg share this tori give everybody. Dis na security information wey go helep you on top your NIMC wey connect to your bank account and your sim card.                        English *SECURITY* Tips: If you have linked your SIM cards to your ID card or not, know these 4 thin

NIN blame network for delay of registration

Prent
Tori As We Dey Waka Come: As we carry waka enter NIN office, we yan with one of Di staff, him yan say, no be small job everyday, plenty pipo go come for registration and after some time, network go bad, na him make dem to dey shut down, dis matter dey make pipo vess, and di Queue dey long well well. We yan with one of di pipo on top dis long Queue, her name na madam chioma. Madam chioma yan on top how she take do her Registration waka, inside NIN office for Abuja. Madam chioma: Dem say make I come back next month after them don give me number inside paper say na him dem go use attend to me, the crowd dey plenty, as early as 8am, pipo don full plenty for long Queue every day, but after 3pm dem go yan say dem wan shut down, say di network no dey work well well again, na till di next dey be that, dis na wetin my eye see, on top dis NIN registration, no be small matter. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We