Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tori As We Dey Waka Come:

Ritualists don confess to Police Command Osun State, say dem dey strangle pipo to death wey dem catch to do ritual.

Di Osun State Police Command catch some ritualists, wey confessed say dem dey kill pipo dey sell part of di body. One of dia customer wey olopa catch, him name na Lukman Garuba, him confess say, him dey buy human body part, from dis ritualist, for N2000.

Na inside Iwo, for Osun State Police catch 31 years old Garuba, dem arrest am for di place wey dis ritualists’ dem dey do dia evil work, inside town with Tajudeen Monsuru, and dem also 25 years old Hamsat Akeem, him follow confess say dem follow waka to pai one person wey him name na Akanbi Adeolu. One Monsuru confess say him kill him girlfriend, Mutiyat Alani and Akinloye Ibrahim and many other pipo. 

Di Osun State Commissioner for Police, Wale Olokode don talk say very soon dem go catch all dis bad pipo wey dey do kidnapping, cultists, and drug dealing dem.

www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.